﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:10,580
Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey,

2
00:00:10,580 --> 00:00:12,680
“Who yu bi sef?”

3
00:00:12,680 --> 00:00:14,240
E ansa dem,

4
00:00:14,240 --> 00:00:16,120
“I nor dey lie,

5
00:00:16,120 --> 00:00:18,240
bikos nor bi mi bi di Christ.”

6
00:00:18,240 --> 00:00:20,060
Den dem ask am,

7
00:00:20,060 --> 00:00:21,620
“So,

8
00:00:21,620 --> 00:00:23,000
na who yu bi?

9
00:00:23,000 --> 00:00:24,700
Abi yu bi Elijah?”

10
00:00:24,700 --> 00:00:26,320
E kon sey,

11
00:00:26,320 --> 00:00:27,540
“No,

12
00:00:27,540 --> 00:00:29,240
I nor bi Elijah.”

13
00:00:29,240 --> 00:00:31,660
Dem ask am again,

14
00:00:31,660 --> 00:00:34,080
“Yu bi di profet?”

15
00:00:34,080 --> 00:00:35,140
E ansa,

16
00:00:35,140 --> 00:00:36,720
“No o-o!”

17
00:00:36,720 --> 00:00:37,320
Again,

18
00:00:37,320 --> 00:00:38,360
dem ask am,

19
00:00:38,360 --> 00:00:40,480
“Who yu bi sef?

20
00:00:40,480 --> 00:00:41,660
Make yu tell us,

21
00:00:41,660 --> 00:00:44,680
so dat wi go know wetin to tell di pipol wey send us.

22
00:00:44,680 --> 00:00:46,740
Who yu sey yu bi?”

23
00:00:46,740 --> 00:00:48,420
John kon sey,

24
00:00:48,420 --> 00:00:52,360
“Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey,

25
00:00:52,360 --> 00:00:57,120
‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’,

26
00:00:57,120 --> 00:00:59,800
as Profet Isaya tok before.”

27
00:00:59,800 --> 00:01:02,980
(Na di Farisee pipol send dis pipol go meet John).

28
00:01:02,980 --> 00:01:05,000
Dem kon ask John sey,

29
00:01:05,000 --> 00:01:07,060
“Why yu dey baptize pipol,

30
00:01:07,060 --> 00:01:11,740
if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”

31
00:01:11,740 --> 00:01:13,500
John ansa dem,

32
00:01:13,500 --> 00:01:16,060
“I dey baptize pipol with wota,

33
00:01:16,060 --> 00:01:17,560
but among una,

34
00:01:17,560 --> 00:01:19,820
one pesin dey wey una nor know.

35
00:01:19,820 --> 00:01:21,840
E go kom afta mi.

36
00:01:21,840 --> 00:01:24,560
I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”

37
00:01:24,560 --> 00:01:31,000
All dis tins happen for Betany where pipol dey cross Jordan River kom meet John,

38
00:01:31,000 --> 00:01:33,720
make e baptize dem.

39
00:01:33,720 --> 00:01:35,720
Wen day break,

40
00:01:35,720 --> 00:01:38,280
John si Jesus dey waka kom meet am,

41
00:01:38,280 --> 00:01:39,480
den John sey,

42
00:01:39,480 --> 00:01:41,680
“Make una look!

43
00:01:41,680 --> 00:01:43,520
Dis na di Sheep wey God send kom die,

44
00:01:43,520 --> 00:01:46,660
so dat God go forgive us awa sins.”

45
00:01:46,660 --> 00:01:48,960
Na dis pesin I tell una sey,

46
00:01:48,960 --> 00:01:50,400
“Afta mi,

47
00:01:50,400 --> 00:01:52,960
one man wey big pass mi go kom,

48
00:01:52,960 --> 00:01:54,440
bikos e dey before mi.

49
00:01:54,440 --> 00:01:56,960
Misef nor know am before,

50
00:01:56,960 --> 00:01:59,000
but I dey baptize pipol with wota,

51
00:01:59,000 --> 00:02:02,360
so dat God go show Israel pipol who Jesus bi.”

52
00:02:02,360 --> 00:02:04,880
Den John bear witness sey,

53
00:02:04,880 --> 00:02:10,160
“I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head.

54
00:02:10,160 --> 00:02:12,640
I nor know am before,

55
00:02:12,640 --> 00:02:16,120
but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey,

56
00:02:16,120 --> 00:02:20,360
‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head,

57
00:02:20,360 --> 00:02:22,860
na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’

58
00:02:22,860 --> 00:02:25,560
I don si am and I bear witness sey,

59
00:02:25,560 --> 00:02:28,260
‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”

