﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,120
Wen three days don pass,

2
00:00:08,120 --> 00:00:08,600
Mary,

3
00:00:08,600 --> 00:00:10,040
wey bi Jesus mama,

4
00:00:10,040 --> 00:00:12,400
go one marriage for Kana,

5
00:00:12,400 --> 00:00:13,560
wey dey for Galilee.

6
00:00:13,560 --> 00:00:17,340
Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.

7
00:00:17,340 --> 00:00:19,080
Wen wine finish,

8
00:00:19,080 --> 00:00:20,940
Jesus mama kon tell am,

9
00:00:20,940 --> 00:00:23,580
“Dia wine don finish.”

10
00:00:23,580 --> 00:00:25,440
Jesus ansa am,

11
00:00:25,440 --> 00:00:26,440
“Mama,

12
00:00:26,440 --> 00:00:28,200
why yu dey tell mi?

13
00:00:28,200 --> 00:00:30,420
My time neva rish.”

14
00:00:30,420 --> 00:00:32,760
So en mama kon tell di savants sey,

15
00:00:32,760 --> 00:00:34,840
“Anytin wey e tell una,

16
00:00:34,840 --> 00:00:36,280
make una do am.”

17
00:00:36,280 --> 00:00:38,120
For dat place,

18
00:00:38,120 --> 00:00:45,320
six big wota pot dey and only one fit kontain about twenty to thirty gallon for wota,

19
00:00:45,320 --> 00:00:49,300
wey di Jew pipol dey use wosh leg as dia tradishon tok.

20
00:00:49,300 --> 00:00:51,380
Jesus tell di savants,

21
00:00:51,380 --> 00:00:55,020
“Make una full di pots with wota.”

22
00:00:55,020 --> 00:00:57,340
So dem kon full all di pot with wota.

23
00:00:57,340 --> 00:00:58,720
Jesus tell dem,

24
00:00:58,720 --> 00:01:04,400
“Make una take some wota from di pot go give di chairman for di party.”

25
00:01:04,400 --> 00:01:04,880
So,

26
00:01:04,880 --> 00:01:06,240
dem do as e tok.

27
00:01:06,240 --> 00:01:09,760
Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine,

28
00:01:09,760 --> 00:01:14,160
bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know),

29
00:01:14,160 --> 00:01:16,740
e koll di man wey dey marry kon tell am sey,

30
00:01:16,740 --> 00:01:19,200
“Wen pesin dey do party,

31
00:01:19,200 --> 00:01:22,160
na betta wine e dey first serve pipol,

32
00:01:22,160 --> 00:01:24,300
den wen di pipol don drink taya,

33
00:01:24,300 --> 00:01:26,560
naim e dey serve cheap wine.

34
00:01:26,560 --> 00:01:30,840
But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”

35
00:01:30,840 --> 00:01:36,800
Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee.

36
00:01:36,800 --> 00:01:38,720
Dis na how e show en honor,

37
00:01:38,720 --> 00:01:40,940
so en disciples kon bilive am.

38
00:01:40,940 --> 00:01:43,280
Den Jesus with en mama,

39
00:01:43,280 --> 00:01:46,360
brodas and en disciples kon go Kapanaum.

40
00:01:46,360 --> 00:01:49,600
Dem kon stay der for some days.

