﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,040
Leta,

2
00:00:06,040 --> 00:00:12,260
Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol.

3
00:00:12,260 --> 00:00:14,640
John dey baptize for Aenon,

4
00:00:14,640 --> 00:00:16,160
one town wey near Salim,

5
00:00:16,160 --> 00:00:21,660
bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem.

6
00:00:21,660 --> 00:00:22,600
(For dis time,

7
00:00:22,600 --> 00:00:24,400
dem neva put John for prison).

8
00:00:24,400 --> 00:00:32,820
Den one Jew man kon dey argue with John disciples about how dem suppose to wosh dia body as dia tradishon tok.

9
00:00:32,820 --> 00:00:35,160
Some among dem go meet John kon tell am,

10
00:00:35,160 --> 00:00:36,400
“Oga God,

11
00:00:36,400 --> 00:00:40,080
di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River,

12
00:00:40,080 --> 00:00:41,880
wey yu tok about before,

13
00:00:41,880 --> 00:00:42,400
en too,

14
00:00:42,400 --> 00:00:45,840
dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”

15
00:00:45,840 --> 00:00:47,960
John ansa dem,

16
00:00:47,960 --> 00:00:51,280
“Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven,

17
00:00:51,280 --> 00:00:51,900
gi-am.

18
00:00:51,900 --> 00:00:54,160
Unasef go fit bear witness sey,

19
00:00:54,160 --> 00:00:56,200
I tok sey I nor bi di Christ,

20
00:00:56,200 --> 00:00:58,160
but God send mi kom,

21
00:00:58,160 --> 00:01:00,360
before Christ go kom.

22
00:01:00,360 --> 00:01:03,840
Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom.

23
00:01:03,840 --> 00:01:04,880
En friend,

24
00:01:04,880 --> 00:01:06,400
wey bi di best man,

25
00:01:06,400 --> 00:01:07,960
dey listin to am.

26
00:01:07,960 --> 00:01:12,580
E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok.

27
00:01:12,580 --> 00:01:16,960
Na dis dey make mi happy and my joy don full.

28
00:01:16,960 --> 00:01:19,840
Pipol must know Christ pass as dem know mi.

29
00:01:19,840 --> 00:01:24,840
“Di pesin wey kom from heaven betta pass evribody wey dey for dis world.

30
00:01:24,840 --> 00:01:26,700
And who dey dis world,

31
00:01:26,700 --> 00:01:29,820
dey tok about di tins wey dey inside di world.

32
00:01:29,820 --> 00:01:35,340
But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven,

33
00:01:35,340 --> 00:01:37,920
but pipol nor gri listin to am.

34
00:01:37,920 --> 00:01:41,040
But pesin wey bilive wetin e tok about God,

35
00:01:41,040 --> 00:01:42,880
bilive sey wetin God tok,

36
00:01:42,880 --> 00:01:43,740
na true.

37
00:01:43,740 --> 00:01:47,400
Di pesin wey God send dey tok about God word,

38
00:01:47,400 --> 00:01:50,120
bikos God dey give en Spirit to pipol.

39
00:01:50,120 --> 00:01:55,640
God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.

40
00:01:55,640 --> 00:01:59,020
Pesin wey bilive di only pikin wey God get,

41
00:01:59,020 --> 00:02:01,320
go get life wey nor dey end.

42
00:02:01,320 --> 00:02:03,280
But pesin wey nor bilive Man Pikin,

43
00:02:03,280 --> 00:02:05,460
nor go get life at-all.

44
00:02:05,460 --> 00:02:10,160
God go always dey vex with dat kind pesin.”

