﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:12,540
Jesus kon know sey di Farisee pipol don hear sey e dey baptize plenty pipol pass John and di pipol dey follow am,

2
00:00:12,540 --> 00:00:16,480
(aldo nor bi Jesus ensef dey baptize pipol,

3
00:00:16,480 --> 00:00:18,540
but na en disciples dey do am).

4
00:00:18,540 --> 00:00:21,740
Jesus komot for Judea dey go Galilee.

5
00:00:21,740 --> 00:00:23,520
For am to rish der,

6
00:00:23,520 --> 00:00:25,860
e go must pass thru Samaria.

7
00:00:25,860 --> 00:00:29,620
E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar,

8
00:00:29,620 --> 00:00:33,160
wey near di land wey Jakob give Josef,

9
00:00:33,160 --> 00:00:34,020
wey bi en pikin.

10
00:00:34,020 --> 00:00:36,700
Jakob well dey der too.

11
00:00:36,700 --> 00:00:37,560
Dat aftanoon,

12
00:00:37,560 --> 00:00:40,320
bikos Jesus don taya to waka,

13
00:00:40,320 --> 00:00:42,160
e kon sidan near di well.

14
00:00:42,160 --> 00:00:45,180
So one woman for di town kom draw wota for di well.

15
00:00:45,180 --> 00:00:46,540
Jesus tell am,

16
00:00:46,540 --> 00:00:49,580
“Abeg give mi wota make I drink.”

17
00:00:49,580 --> 00:00:50,700
By dis time,

18
00:00:50,700 --> 00:00:53,480
en disciples don go inside di town go buy food.

19
00:00:53,480 --> 00:00:55,780
Den di woman kon tell Jesus,

20
00:00:55,780 --> 00:00:59,560
“How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin,

21
00:00:59,560 --> 00:01:00,080
sey,

22
00:01:00,080 --> 00:01:02,720
‘Make I give yu wota drink?’ ”

23
00:01:02,720 --> 00:01:07,680
(E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)

24
00:01:07,680 --> 00:01:09,960
Jesus ansa am,

25
00:01:09,960 --> 00:01:15,440
“If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so,

26
00:01:15,440 --> 00:01:20,580
yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”

27
00:01:20,580 --> 00:01:22,360
Di woman ask am,

28
00:01:22,360 --> 00:01:24,280
“Oga God,

29
00:01:24,280 --> 00:01:27,680
yu nor get bucket and di well deep well-well,

30
00:01:27,680 --> 00:01:30,140
where yu go fit get dat kind wota?

31
00:01:30,140 --> 00:01:34,320
Yu big pass awa grand-grand papa Jakob wey give us dis well,

32
00:01:34,320 --> 00:01:37,220
where en family and animals dey drink from?”

33
00:01:37,220 --> 00:01:39,440
Jesus ansa,

34
00:01:39,440 --> 00:01:43,640
“Pesin wey drink from dis wota go always dey hongry for wota.

35
00:01:43,640 --> 00:01:47,440
But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am,

36
00:01:47,440 --> 00:01:49,660
nor go hongry for wota again,

37
00:01:49,660 --> 00:01:51,800
bikos di wota wey I go gi-am,

38
00:01:51,800 --> 00:01:59,540
go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”

39
00:01:59,540 --> 00:02:00,920
Di woman kon tell am,

40
00:02:00,920 --> 00:02:03,000
“Oga God,

41
00:02:03,000 --> 00:02:04,640
give mi dis wota,

42
00:02:04,640 --> 00:02:09,300
so dat I nor go hongry for wota or kom here kon draw wota again.”

43
00:02:09,300 --> 00:02:10,580
Jesus tell am,

44
00:02:10,580 --> 00:02:13,040
“Go koll yor husband,

45
00:02:13,040 --> 00:02:15,200
make two of una kom meet mi.”

46
00:02:15,200 --> 00:02:16,640
Di woman ansa,

47
00:02:16,640 --> 00:02:19,400
“I nor get husband.”

48
00:02:19,400 --> 00:02:21,840
Den Jesus kon tell am,

49
00:02:21,840 --> 00:02:24,740
“Yu tok true wen yu sey ‘I nor get husband.’

50
00:02:24,740 --> 00:02:30,240
Bikos yu don marry five husband before and di man wey yu dey stay with naw,

51
00:02:30,240 --> 00:02:31,760
nor bi yor real husband.

52
00:02:31,760 --> 00:02:32,860
Na true yu tok.”

53
00:02:32,860 --> 00:02:35,120
Di woman kon tell am,

54
00:02:35,120 --> 00:02:36,880
“Oga God,

55
00:02:36,880 --> 00:02:39,700
I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen.

56
00:02:39,700 --> 00:02:42,720
Awa papa dem serve God for dis mountin,

57
00:02:42,720 --> 00:02:44,840
but una kon tok sey,

58
00:02:44,840 --> 00:02:47,280
di place wey pipol suppose to woship God,

59
00:02:47,280 --> 00:02:49,060
na Jerusalem e dey.”

60
00:02:49,060 --> 00:02:50,720
Jesus kon sey,

61
00:02:50,720 --> 00:02:52,520
“Woman,

62
00:02:52,520 --> 00:02:54,200
make yu bilive mi,

63
00:02:54,200 --> 00:02:55,480
di time dey kom,

64
00:02:55,480 --> 00:02:59,620
wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey,

65
00:02:59,620 --> 00:03:03,180
nor bi only for dis mountin or for Jerusalem.

66
00:03:03,180 --> 00:03:05,480
Una dey serve wetin una nor know,

67
00:03:05,480 --> 00:03:08,420
but wi dey serve wetin wi know,

68
00:03:08,420 --> 00:03:10,600
bikos na Jew pipol,

69
00:03:10,600 --> 00:03:12,420
naim God first koll to ensef.

70
00:03:12,420 --> 00:03:16,440
But di time dey kom and e don even rish,

71
00:03:16,440 --> 00:03:19,080
wen di pipol wey won really serve God,

72
00:03:19,080 --> 00:03:21,400
go serve am for di true way,

73
00:03:21,400 --> 00:03:23,120
wey God Spirit go show dem.

74
00:03:23,120 --> 00:03:27,200
God na Spirit and di pipol wey won serve am,

75
00:03:27,200 --> 00:03:31,200
must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”

76
00:03:31,200 --> 00:03:32,800
Di woman ansa,

77
00:03:32,800 --> 00:03:37,040
“I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ),

78
00:03:37,040 --> 00:03:39,120
wey go save evribody,

79
00:03:39,120 --> 00:03:41,920
go kom and anytime wen e kom,

80
00:03:41,920 --> 00:03:43,860
e go tell us evritin.”

81
00:03:43,860 --> 00:03:46,000
Jesus kon tell am,

82
00:03:46,000 --> 00:03:48,400
“Na mi wey dey tok to yu so,

83
00:03:48,400 --> 00:03:50,300
bi di Mezaya.”

84
00:03:50,300 --> 00:03:53,440
Wen Jesus dey tok to di woman,

85
00:03:53,440 --> 00:03:55,860
en disciples kon kom back.

86
00:03:55,860 --> 00:03:58,880
Dem sopraiz sey e dey tok with one woman,

87
00:03:58,880 --> 00:04:00,360
but dem nor fit ask am,

88
00:04:00,360 --> 00:04:01,440
“Wetin e wont?”

89
00:04:01,440 --> 00:04:03,160
or “Why e dey tok to di woman?”

90
00:04:03,160 --> 00:04:04,820
By dis time,

91
00:04:04,820 --> 00:04:11,480
di woman don leave en pot wey e take kom draw wota kon run go inside di town go tell pipol sey,

92
00:04:11,480 --> 00:04:18,460
“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do.

93
00:04:18,460 --> 00:04:20,860
Dis man nor bi di Mezaya so?”

94
00:04:20,860 --> 00:04:24,480
So di pipol kom out for di town go meet Jesus.

95
00:04:24,480 --> 00:04:25,960
By dis time,

96
00:04:25,960 --> 00:04:27,520
di disciples kon beg am,

97
00:04:27,520 --> 00:04:29,080
“Tisha,

98
00:04:29,080 --> 00:04:31,060
make yu chop sometin naw.”

99
00:04:31,060 --> 00:04:32,700
But e tell dem,

100
00:04:32,700 --> 00:04:36,760
“I get food wey I go chop wey una nor know about.”

101
00:04:36,760 --> 00:04:39,780
Di disciples kon dey ask demsef,

102
00:04:39,780 --> 00:04:44,140
“Abi somebody don bring sometin for am to chop wen wi nor dey here?”

103
00:04:44,140 --> 00:04:46,340
Jesus kon tell dem,

104
00:04:46,340 --> 00:04:52,120
“My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.

105
00:04:52,120 --> 00:04:54,080
Nor bi una dey tok sey,

106
00:04:54,080 --> 00:04:59,100
‘Na for monts remain before dem go plok fruit wey dem plant for farm?’

107
00:04:59,100 --> 00:05:04,600
Make una look round and una go si sey fruit don ripe rish to plok.

108
00:05:04,600 --> 00:05:14,080
God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end.

109
00:05:14,080 --> 00:05:14,560
So,

110
00:05:14,560 --> 00:05:19,120
di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant,

111
00:05:19,120 --> 00:05:20,180
go happy togeda.

112
00:05:20,180 --> 00:05:22,020
Dis one show sey,

113
00:05:22,020 --> 00:05:24,040
di tin wey pipol dey tok sey,

114
00:05:24,040 --> 00:05:27,600
‘One pesin plant and anoda pesin plok di fruit’,

115
00:05:27,600 --> 00:05:28,280
na true word.

116
00:05:28,280 --> 00:05:31,220
I send una go plok wetin una nor plant.

117
00:05:31,220 --> 00:05:33,640
Oda pipol don sofa plant dem,

118
00:05:33,640 --> 00:05:36,380
but una kon enjoy wetin dem sofa for.”

119
00:05:36,380 --> 00:05:38,020
By dis time,

120
00:05:38,020 --> 00:05:40,980
many pipol from Samaria town kon bilive am,

121
00:05:40,980 --> 00:05:43,680
bikos of di tins wey di woman tok,

122
00:05:43,680 --> 00:05:46,680
“E tell mi all di tins wey I don do.”

123
00:05:46,680 --> 00:05:49,140
Wen Samaria pipol kom meet am,

124
00:05:49,140 --> 00:05:51,240
dem kon dey beg am sey,

125
00:05:51,240 --> 00:05:52,600
make e stay with dem.

126
00:05:52,600 --> 00:05:54,840
So e kon stay der for two days,

127
00:05:54,840 --> 00:05:57,100
and bikos of wetin e tok,

128
00:05:57,100 --> 00:05:58,820
many pipol kon bilive am.

129
00:05:58,820 --> 00:06:01,440
Den dem kon tell di woman,

130
00:06:01,440 --> 00:06:04,380
“Nor bi wetin yu tell us make us bilive,

131
00:06:04,380 --> 00:06:08,840
but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey,

132
00:06:08,840 --> 00:06:10,440
dis pesin true-true,

133
00:06:10,440 --> 00:06:14,340
na-im go save all di pipol wey dey dis world.”

