﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,780
Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day,

2
00:00:08,780 --> 00:00:11,260
di Jew oga dem kon dey make trobol with am.

3
00:00:11,260 --> 00:00:12,980
So e tell dem,

4
00:00:12,980 --> 00:00:17,620
“My Papa dey work evritime and na so mi too dey work.”

5
00:00:17,620 --> 00:00:19,500
Bikos of dis,

6
00:00:19,500 --> 00:00:22,260
di Jew oga dem kon dey try to kill-am,

7
00:00:22,260 --> 00:00:27,120
bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa,

8
00:00:27,120 --> 00:00:29,200
like sey en and God na mate.

9
00:00:29,200 --> 00:00:31,240
Naim Jesus ansa dem,

10
00:00:31,240 --> 00:00:33,440
“Make I tell una true word,

11
00:00:33,440 --> 00:00:36,760
di Pikin nor fit do anytin with en own mind,

12
00:00:36,760 --> 00:00:39,960
escept di tins wey e si en Papa dey do.

13
00:00:39,960 --> 00:00:42,640
And na anytin wey e si en Papa dey do,

14
00:00:42,640 --> 00:00:44,200
naim e dey do too.

15
00:00:44,200 --> 00:00:46,960
Bikos di Papa get strong love for en pikin,

16
00:00:46,960 --> 00:00:55,420
e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.

17
00:00:55,420 --> 00:00:59,100
As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die,

18
00:00:59,100 --> 00:01:05,600
na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give.

19
00:01:05,600 --> 00:01:08,220
Di Papa nor dey judge anybody,

20
00:01:08,220 --> 00:01:12,080
but e don give en pikin pawa to judge evribody,

21
00:01:12,080 --> 00:01:17,840
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa.

22
00:01:17,840 --> 00:01:21,120
If anybody nor bow show respet for di pikin,

23
00:01:21,120 --> 00:01:25,640
e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.

24
00:01:25,640 --> 00:01:27,520
“I tell una true word,

25
00:01:27,520 --> 00:01:32,920
di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi,

26
00:01:32,920 --> 00:01:37,800
go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire,

27
00:01:37,800 --> 00:01:41,220
but e go get life wey nor dey end.

28
00:01:41,220 --> 00:01:43,180
I tell una true word,

29
00:01:43,180 --> 00:01:46,680
di time dey kom and e don even rish groun naw,

30
00:01:46,680 --> 00:01:52,080
wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am,

31
00:01:52,080 --> 00:01:55,140
dem go wake-up and dem nor go die again.

32
00:01:55,140 --> 00:01:58,240
Bikos as di Papa get life for inside am,

33
00:01:58,240 --> 00:02:00,440
na so e give en pikin life too.

34
00:02:00,440 --> 00:02:03,940
Di Papa don give en pikin di pawa to judge pipol.

35
00:02:03,940 --> 00:02:05,180
“So,

36
00:02:05,180 --> 00:02:07,480
make dis word nor sopraiz una,

37
00:02:07,480 --> 00:02:09,800
bikos di time dey kom,

38
00:02:09,800 --> 00:02:13,940
wen all doz wey dey inside grave go hear di pikin vois,

39
00:02:13,940 --> 00:02:17,960
and di angels go kon separate di pipol wey do good tins,

40
00:02:17,960 --> 00:02:20,600
so dat dem go enter life wey nor dey end,

41
00:02:20,600 --> 00:02:24,840
but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins.

42
00:02:24,840 --> 00:02:28,440
I nor go fit do anytin with my own pawa,

43
00:02:28,440 --> 00:02:31,160
but na wetin I dey hear from my Papa,

44
00:02:31,160 --> 00:02:34,140
naim I dey use take judge.

45
00:02:34,140 --> 00:02:36,080
Any judgement wey I give,

46
00:02:36,080 --> 00:02:37,600
na true one,

47
00:02:37,600 --> 00:02:39,920
bikos I nor dey do my own tin,

48
00:02:39,920 --> 00:02:42,680
but I only dey do as my Papa send mi.

49
00:02:42,680 --> 00:02:45,600
“If I tok about mysef,

50
00:02:45,600 --> 00:02:48,620
e fit bi sey wetin I tok nor bi true”,

51
00:02:48,620 --> 00:02:55,160
bikos anoda pesin dey wey go tok about mi and I know sey wetin e tok about mi,

52
00:02:55,160 --> 00:02:56,060
na true.

53
00:02:56,060 --> 00:03:00,320
“Una don send message go meet John and e don tell una true word.

54
00:03:00,320 --> 00:03:03,000
(I nor dey trust wetin pipol tok,

55
00:03:03,000 --> 00:03:06,600
but I dey tell una dis word make God for save una.)

56
00:03:06,600 --> 00:03:13,740
John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”

57
00:03:13,740 --> 00:03:18,660
But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John,

58
00:03:18,660 --> 00:03:21,720
bikos di work wey my Papa give mi make I do,

59
00:03:21,720 --> 00:03:23,080
naim I dey do so;

60
00:03:23,080 --> 00:03:25,600
so di work dey bear witness sey,

61
00:03:25,600 --> 00:03:26,920
na my Papa send mi.

62
00:03:26,920 --> 00:03:29,000
And my Papa wey send mi,

63
00:03:29,000 --> 00:03:32,760
en ensef don bear witness about mi.

64
00:03:32,760 --> 00:03:36,220
Una neva hear my Papa vois or si am before.

65
00:03:36,220 --> 00:03:39,520
En word neva still dey inside una,

66
00:03:39,520 --> 00:03:42,220
bikos una nor bilive sey na-im send mi.

67
00:03:42,220 --> 00:03:45,500
Una dey read God word well-well,

68
00:03:45,500 --> 00:03:48,480
bikos una bilive sey na wetin una read,

69
00:03:48,480 --> 00:03:54,140
go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,

70
00:03:54,140 --> 00:03:57,120
but una nor ready to kom meet mi,

71
00:03:57,120 --> 00:03:59,900
so dat una go get life wey nor dey end.

72
00:03:59,900 --> 00:04:02,380
“I nor like make pipol dey praiz mi,

73
00:04:02,380 --> 00:04:04,240
bikos I know sey,

74
00:04:04,240 --> 00:04:06,860
una nor love God for inside una heart.

75
00:04:06,860 --> 00:04:10,880
I kom with my Papa name and una nor gri asept mi,

76
00:04:10,880 --> 00:04:13,860
but if anoda pesin kom with en own name,

77
00:04:13,860 --> 00:04:15,460
una go asept am.

78
00:04:15,460 --> 00:04:23,620
How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.

79
00:04:23,620 --> 00:04:28,160
“Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa.

80
00:04:28,160 --> 00:04:32,840
Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite,

81
00:04:32,840 --> 00:04:35,000
wey una dey put hope for.

82
00:04:35,000 --> 00:04:38,360
If una bilive wetin Moses rite for di law,

83
00:04:38,360 --> 00:04:40,440
una suppose to bilive mi too,

84
00:04:40,440 --> 00:04:42,720
bikos na mi e rite about.

85
00:04:42,720 --> 00:04:46,060
But if una nor bilive wetin Moses rite,

86
00:04:46,060 --> 00:04:50,720
how una go take bilive wetin I dey tell una naw?”

