﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,660
Wen Jesus don tok finish,

2
00:00:07,660 --> 00:00:12,160
e kon cross go Tiberias wey dey di oda side for Galilee wotaside.

3
00:00:12,160 --> 00:00:14,520
Plenty pipol follow am,

4
00:00:14,520 --> 00:00:16,760
bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.

5
00:00:16,760 --> 00:00:22,280
Jesus komot for der go di mountin side kon sidan der with en disciples.

6
00:00:22,280 --> 00:00:23,520
(Dat time,

7
00:00:23,520 --> 00:00:25,780
Passova Feast don rish.)

8
00:00:25,780 --> 00:00:27,640
Wen Jesus look up,

9
00:00:27,640 --> 00:00:30,160
e si plenty pipol dey kom meet am.

10
00:00:30,160 --> 00:00:31,840
Den e ask Filip,

11
00:00:31,840 --> 00:00:36,980
“Na where wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?”

12
00:00:36,980 --> 00:00:40,720
Jesus tok dis one make e for si wetin Filip go do,

13
00:00:40,720 --> 00:00:43,520
bikos en ensef know wetin e won do.

14
00:00:43,520 --> 00:00:44,960
Filip ansa,

15
00:00:44,960 --> 00:00:51,600
“Even if wi buy bread wey rish two hundred silva koins and if dem share am small-small,

16
00:00:51,600 --> 00:00:53,420
e nor go rish evribody chop.”

17
00:00:53,420 --> 00:00:57,040
Anoda disciple wey en name bi Andru,

18
00:00:57,040 --> 00:00:59,820
wey bi Simon Pita broda kon tell Jesus sey,

19
00:00:59,820 --> 00:01:04,160
“One boy dey here wey get five bread and two fish,

20
00:01:04,160 --> 00:01:08,220
but dis one nor go rish dis plenty pipol chop at-all!”

21
00:01:08,220 --> 00:01:09,760
Jesus ansa,

22
00:01:09,760 --> 00:01:17,480
“Tell all di pipol make dem sidan” (as plenty grass dey di place wey dem go fit sidan put).

23
00:01:17,480 --> 00:01:18,200
Di men wey sidan,

24
00:01:18,200 --> 00:01:19,940
rish 5,000.

25
00:01:19,940 --> 00:01:22,920
Jesus take di bread kon tank God.

26
00:01:22,920 --> 00:01:25,800
Den e divide am give di pipol wey sidan.

27
00:01:25,800 --> 00:01:28,120
E do di same tin with di fish.

28
00:01:28,120 --> 00:01:32,120
All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.

29
00:01:32,120 --> 00:01:34,520
Wen evribody don beleful,

30
00:01:34,520 --> 00:01:36,120
Jesus kon tell en disciples,

31
00:01:36,120 --> 00:01:38,720
“Make una gada wetin remain,

32
00:01:38,720 --> 00:01:40,880
make anytin nor waste.”

33
00:01:40,880 --> 00:01:45,520
Wen dem gada wetin dem chop remain for di five bread,

34
00:01:45,520 --> 00:01:47,320
e full twelf basket.

35
00:01:47,320 --> 00:01:50,160
So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do,

36
00:01:50,160 --> 00:01:52,600
dem kon dey tok among demsef sey,

37
00:01:52,600 --> 00:01:54,360
“True-true,

38
00:01:54,360 --> 00:01:58,380
dis man na di profet wey God send kom dis world.”

39
00:01:58,380 --> 00:02:03,720
Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king,

40
00:02:03,720 --> 00:02:06,900
only en kon komot go on-top di mountin alone.

