﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,400
Wen day don break,

2
00:00:07,400 --> 00:00:13,060
di pipol wey dey di oda side for di river know sey na only one small kenu dey der.

3
00:00:13,060 --> 00:00:16,200
Dem still know sey Jesus enter di kenu with dem.

4
00:00:16,200 --> 00:00:23,180
So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread,

5
00:00:23,180 --> 00:00:24,900
afta Jesus don pray.

6
00:00:24,900 --> 00:00:29,280
So wen di pipol si sey Jesus and en disciples nor dey der,

7
00:00:29,280 --> 00:00:35,400
dem enter di kenu kon go look for Jesus for anoda town wey dem dey koll Kapanaum.

8
00:00:35,400 --> 00:00:38,640
Wen dem si Jesus for di oda side for di river,

9
00:00:38,640 --> 00:00:39,780
dem ask am,

10
00:00:39,780 --> 00:00:41,060
“Tisha,

11
00:00:41,060 --> 00:00:42,900
wish time yu kom here?”

12
00:00:42,900 --> 00:00:44,920
Jesus ansa dem,

13
00:00:44,920 --> 00:00:47,060
“Make I tell una true word,

14
00:00:47,060 --> 00:00:51,760
na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi,

15
00:00:51,760 --> 00:00:53,960
nor bi bikos of di mirakles wey una si.

16
00:00:53,960 --> 00:00:57,680
Make una nor work for food wey nor dey last,

17
00:00:57,680 --> 00:01:03,700
but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food,

18
00:01:03,700 --> 00:01:05,880
na only Man Pikin go fit give una,

19
00:01:05,880 --> 00:01:08,320
bikos na-im God send kom.”

20
00:01:08,320 --> 00:01:10,300
Dem kon ask am,

21
00:01:10,300 --> 00:01:14,180
“Wetin wi go do to make God happy with us?”

22
00:01:14,180 --> 00:01:16,040
Jesus ansa,

23
00:01:16,040 --> 00:01:21,080
“God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”

24
00:01:21,080 --> 00:01:23,240
Dem still ask Jesus,

25
00:01:23,240 --> 00:01:25,960
“Wish kind mirakle yu go do make wi si,

26
00:01:25,960 --> 00:01:27,680
make wi for bilive yu?

27
00:01:27,680 --> 00:01:32,620
Awa grand-grand papa dem chop manna for wildaness as dem rite for God word sey,

28
00:01:32,620 --> 00:01:35,040
‘God give dem bread from heaven to chop.’ ”

29
00:01:35,040 --> 00:01:38,180
Den Jesus tell dem,

30
00:01:38,180 --> 00:01:39,940
“Make I tell una true word,

31
00:01:39,940 --> 00:01:43,080
nor bi Moses give una bread from heaven,

32
00:01:43,080 --> 00:01:44,320
but God,

33
00:01:44,320 --> 00:01:45,480
wey bi my Papa,

34
00:01:45,480 --> 00:01:48,320
na-im give una di true bread from heaven.

35
00:01:48,320 --> 00:01:55,560
God bread na di pesin wey kom down from heaven kon give betta life to di pipol wey dey dis world.”

36
00:01:55,560 --> 00:01:56,960
So dem tell am,

37
00:01:56,960 --> 00:01:58,680
“Oga God,

38
00:01:58,680 --> 00:01:59,640
from naw go,

39
00:01:59,640 --> 00:02:02,340
make yu give us dis bread.”

40
00:02:02,340 --> 00:02:04,320
Jesus kon tell dem,

41
00:02:04,320 --> 00:02:07,520
“Na mi bi di bread wey dey give life.

42
00:02:07,520 --> 00:02:13,140
Pesin wey kom meet mi nor go hongry lie-lie and di pesin wey bilive mi,

43
00:02:13,140 --> 00:02:15,160
nor go hongry for wota again.

44
00:02:15,160 --> 00:02:16,880
As I don tell una,

45
00:02:16,880 --> 00:02:17,960
una dey si mi,

46
00:02:17,960 --> 00:02:19,240
but una nor bilive.

47
00:02:19,240 --> 00:02:23,280
Anybody wey my Papa give mi,

48
00:02:23,280 --> 00:02:25,960
go kom meet mi and wen e kom,

49
00:02:25,960 --> 00:02:27,880
I nor go ever drive am.

50
00:02:27,880 --> 00:02:32,440
Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven,

51
00:02:32,440 --> 00:02:34,620
but na to do wetin my Papa wont.

52
00:02:34,620 --> 00:02:37,200
Wetin my Papa wey send mi wont,

53
00:02:37,200 --> 00:02:40,400
na make I nor luz anybody wey e give mi,

54
00:02:40,400 --> 00:02:44,120
but make I for take dem go up for di last day.

55
00:02:44,120 --> 00:02:46,760
Wetin my Papa wont bi sey,

56
00:02:46,760 --> 00:02:49,040
anybody wey bilive en pikin,

57
00:02:49,040 --> 00:02:54,600
go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”

58
00:02:54,600 --> 00:02:58,980
Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus,

59
00:02:58,980 --> 00:03:00,580
bikos e tok sey,

60
00:03:00,580 --> 00:03:04,120
“Na mi bi di bread wey kom down from heaven.”

61
00:03:04,120 --> 00:03:06,020
Den dem sey,

62
00:03:06,020 --> 00:03:09,160
“Dis Jesus sef nor bi Josef pikin,

63
00:03:09,160 --> 00:03:11,080
wey wi know en papa and mama?

64
00:03:11,080 --> 00:03:13,200
Na how e kon dey tok sey,

65
00:03:13,200 --> 00:03:15,360
‘I kom down from heaven?’ ”

66
00:03:15,360 --> 00:03:17,040
Jesus ansa,

67
00:03:17,040 --> 00:03:20,580
“Make una nor komplain about mi give each oda.

68
00:03:20,580 --> 00:03:24,000
Nobody go fit kom meet mi with en own pawa,

69
00:03:24,000 --> 00:03:30,600
unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day.

70
00:03:30,600 --> 00:03:32,920
Na so di profets rite sey,

71
00:03:32,920 --> 00:03:35,080
‘God go tish evribody.’

72
00:03:35,080 --> 00:03:37,720
Anybody wey hear wetin my Papa tok,

73
00:03:37,720 --> 00:03:38,980
go kom meet mi.

74
00:03:38,980 --> 00:03:42,760
(Nor bi sey anybody don si di Papa before,

75
00:03:42,760 --> 00:03:45,660
escept mi wey kom from heaven).

76
00:03:45,660 --> 00:03:48,000
I dey tell una true word,

77
00:03:48,000 --> 00:03:50,000
anybody wey bilive mi,

78
00:03:50,000 --> 00:03:52,240
don get life wey nor dey end.

79
00:03:52,240 --> 00:03:56,640
Na mi bi di bread wey dey give pesin life.

80
00:03:56,640 --> 00:04:00,520
Una grand-grand papa dem chop manna for wildaness,

81
00:04:00,520 --> 00:04:01,920
but dem still die.

82
00:04:01,920 --> 00:04:04,680
Dis na di bread wey kom from heaven,

83
00:04:04,680 --> 00:04:06,560
so dat anybody wey chop am,

84
00:04:06,560 --> 00:04:08,940
go get life wey nor dey end.

85
00:04:08,940 --> 00:04:13,320
Na mi bi di bread wey kom down from heaven.

86
00:04:13,320 --> 00:04:16,560
Anybody wey chop dis bread go live forever.

87
00:04:16,560 --> 00:04:21,500
Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”

88
00:04:21,500 --> 00:04:27,440
Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey,

89
00:04:27,440 --> 00:04:30,720
“How dis man go give us en flesh make wi chop?”

90
00:04:30,720 --> 00:04:32,460
Jesus tell dem,

91
00:04:32,460 --> 00:04:35,000
“I dey tell una true word,

92
00:04:35,000 --> 00:04:39,300
unless una chop Man Pikin flesh and drink en blood,

93
00:04:39,300 --> 00:04:41,820
una nor go get life for inside una.

94
00:04:41,820 --> 00:04:45,440
Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood,

95
00:04:45,440 --> 00:04:50,060
don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.

96
00:04:50,060 --> 00:04:55,500
My flesh na di real food and my blood na di korrect drink.

97
00:04:55,500 --> 00:04:59,840
Di pesin wey chop my flesh and drink my blood,

98
00:04:59,840 --> 00:05:03,380
go stay inside mi and I go dey inside am too.

99
00:05:03,380 --> 00:05:09,640
Na my Papa wey dey for heaven send mi and as I dey for dis life bikos of am,

100
00:05:09,640 --> 00:05:13,040
na so di pesin wey chop my flesh go get life,

101
00:05:13,040 --> 00:05:13,940
bikos of mi.

102
00:05:13,940 --> 00:05:16,660
Dis na di bread wey kom down from heaven,

103
00:05:16,660 --> 00:05:21,200
e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta,

104
00:05:21,200 --> 00:05:22,560
dem still die.

105
00:05:22,560 --> 00:05:26,060
Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die,

106
00:05:26,060 --> 00:05:27,800
but e go live forever.”

107
00:05:27,800 --> 00:05:32,740
Jesus tok dis tins wen e dey tish dem for inside di temple for Kapanaum.

108
00:05:32,740 --> 00:05:36,120
Wen Jesus many disciples hear wetin e tok,

109
00:05:36,120 --> 00:05:37,040
dem kon sey,

110
00:05:37,040 --> 00:05:40,960
“Dis tin wey Jesus dey tok so hard well-well o-o!

111
00:05:40,960 --> 00:05:43,340
Na who go fit undastand dem?”

112
00:05:43,340 --> 00:05:47,000
Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok,

113
00:05:47,000 --> 00:05:48,480
e kon ask dem,

114
00:05:48,480 --> 00:05:52,260
“Wetin I tok so dey make una vex too?

115
00:05:52,260 --> 00:05:57,800
Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before?

116
00:05:57,800 --> 00:06:01,400
Na di Spirit go fit give pesin life;

117
00:06:01,400 --> 00:06:03,760
human being pawa nor fit do am.

118
00:06:03,760 --> 00:06:07,080
All dis word wey I dey tell una so,

119
00:06:07,080 --> 00:06:10,880
dem bi Spirit and dem dey give pesin life.

120
00:06:10,880 --> 00:06:13,880
But some of una nor bilive.”

121
00:06:13,880 --> 00:06:15,080
(From biginnin,

122
00:06:15,080 --> 00:06:21,600
Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)

123
00:06:21,600 --> 00:06:23,080
So Jesus kon sey,

124
00:06:23,080 --> 00:06:26,200
“Na bikos of dis I tell una sey,

125
00:06:26,200 --> 00:06:29,520
nobody go fit kom meet mi with en own pawa,

126
00:06:29,520 --> 00:06:31,920
unless my Papa let am kom.”

127
00:06:31,920 --> 00:06:33,280
Afta dis,

128
00:06:33,280 --> 00:06:35,860
Jesus many disciples kon stop to follow am.

129
00:06:35,860 --> 00:06:39,120
Den Jesus ask en twelf disciples,

130
00:06:39,120 --> 00:06:40,920
“Una won go too?”

131
00:06:40,920 --> 00:06:43,480
Den Simon Pita ansa am,

132
00:06:43,480 --> 00:06:44,560
“Oga God,

133
00:06:44,560 --> 00:06:46,900
na who wi go kon go meet?

134
00:06:46,900 --> 00:06:50,760
Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end.

135
00:06:50,760 --> 00:06:53,360
Wi don bilive and know sey,

136
00:06:53,360 --> 00:06:56,880
‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”

137
00:06:56,880 --> 00:06:59,220
Jesus ansa,

138
00:06:59,220 --> 00:07:01,840
“Nor bi twelf of una I choose?

139
00:07:01,840 --> 00:07:05,300
But one pesin among una na devil pikin.”

140
00:07:05,300 --> 00:07:07,740
(E tok dis one about Judas,

141
00:07:07,740 --> 00:07:09,880
wey bi Simon Iskariot pikin,

142
00:07:09,880 --> 00:07:11,680
bikos na dis Judas,

143
00:07:11,680 --> 00:07:14,180
wey bi one among en twelf disciples,

144
00:07:14,180 --> 00:07:18,000
naim go sell am give en enemy.)

