﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,480
Den Jesus waka enter Mount Olives.

2
00:00:08,480 --> 00:00:09,980
For early morning,

3
00:00:09,980 --> 00:00:11,620
e enter di temple.

4
00:00:11,620 --> 00:00:16,020
Plenty pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem.

5
00:00:16,020 --> 00:00:25,440
Di pipol wey sabi di law and di Farisee pipol kon bring one woman wey dem katch sey e sleep with man wey nor bi en husband.

6
00:00:25,440 --> 00:00:28,180
Dem kon make am stand for dia front,

7
00:00:28,180 --> 00:00:30,480
den dem tell Jesus,

8
00:00:30,480 --> 00:00:32,480
“Tisha,

9
00:00:32,480 --> 00:00:37,060
wi katch dis woman wen e dey sleep with one man wey nor bi en husband.

10
00:00:37,060 --> 00:00:38,560
Moses Law sey,

11
00:00:38,560 --> 00:00:41,680
‘Make dem stone dis kind woman die.’

12
00:00:41,680 --> 00:00:45,040
Wetin yu get to tok for dis matter?”

13
00:00:45,040 --> 00:00:48,340
(Dem ask am dis kweshon to set trap for am,

14
00:00:48,340 --> 00:00:50,000
make dem for fit katch am).

15
00:00:50,000 --> 00:00:53,360
But Jesus bend down kon take en finger dey rite sometin for groun.

16
00:00:53,360 --> 00:00:55,500
Wen dem kontinue to dey worry am,

17
00:00:55,500 --> 00:00:57,280
e kon get up tell dem,

18
00:00:57,280 --> 00:01:00,820
“Any of una wey neva kommit sin before,

19
00:01:00,820 --> 00:01:04,020
make e bi di first pesin to stone dis woman.”

20
00:01:04,020 --> 00:01:06,720
E kon bend down again bigin rite for groun.

21
00:01:06,720 --> 00:01:09,200
Wen dem hear wetin e tok,

22
00:01:09,200 --> 00:01:10,640
dem kon dey komot for der one-by-one.

23
00:01:10,640 --> 00:01:13,800
Na di old pipol first start to komot,

24
00:01:13,800 --> 00:01:17,740
till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.

25
00:01:17,740 --> 00:01:20,440
Den Jesus stand up ask am,

26
00:01:20,440 --> 00:01:21,520
“Madam,

27
00:01:21,520 --> 00:01:23,740
where di pipol wey bring yu?

28
00:01:23,740 --> 00:01:26,200
Nobody remain to kondemn yu?”

29
00:01:26,200 --> 00:01:33,920
Di woman ansa,

30
00:01:33,920 --> 00:01:36,060
“Oga God,

31
00:01:36,060 --> 00:01:38,060
nobody remain.”

32
00:01:38,060 --> 00:01:40,080
Den Jesus tell am,

33
00:01:40,080 --> 00:01:42,540
“Mi too nor go kondemn yu.

34
00:01:42,540 --> 00:01:44,280
But from naw go,

35
00:01:44,280 --> 00:01:46,520
make yu nor sin again.”

