﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:09,580
Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish.

2
00:00:09,580 --> 00:00:18,440
Dat na di time wey rain dey fall (and kold dey strong well-well) and Jesus kon dey waka inside di varanda where Solomon for dey take breeze,

3
00:00:18,440 --> 00:00:20,460
wey dey inside di temple yard.

4
00:00:20,460 --> 00:00:22,820
Di Jew oga dem gada round Jesus,

5
00:00:22,820 --> 00:00:24,000
kon ask am,

6
00:00:24,000 --> 00:00:26,520
“How long yu go make us dey wait?

7
00:00:26,520 --> 00:00:27,820
If na yu bi di Christ,

8
00:00:27,820 --> 00:00:28,940
make yu tell us.”

9
00:00:28,940 --> 00:00:31,040
Jesus ansa dem,

10
00:00:31,040 --> 00:00:34,420
“I don tell una and una nor bilive.

11
00:00:34,420 --> 00:00:36,180
Di tin wey I take my Papa name dey do,

12
00:00:36,180 --> 00:00:38,020
dey bear witness for mi.

13
00:00:38,020 --> 00:00:41,700
But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep.

14
00:00:41,700 --> 00:00:46,840
My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.

15
00:00:46,840 --> 00:00:51,940
I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die.

16
00:00:51,940 --> 00:00:54,960
Nobody go fit take dem komot from my hand.

17
00:00:54,960 --> 00:01:02,140
My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand,

18
00:01:02,140 --> 00:01:03,900
bikos mi and my Papa,

19
00:01:03,900 --> 00:01:05,000
na one.”

20
00:01:05,000 --> 00:01:07,740
Di Jew oga dem kon pick stone again,

21
00:01:07,740 --> 00:01:08,560
won kon stone am.

22
00:01:08,560 --> 00:01:10,700
So Jesus tell dem,

23
00:01:10,700 --> 00:01:14,120
“I don do many good tins wey una si from my Papa,

24
00:01:14,120 --> 00:01:16,600
wish one make una won stone mi so?”

25
00:01:16,600 --> 00:01:18,980
Di Jew oga dem ansa,

26
00:01:18,980 --> 00:01:22,220
“Wi nor won stone yu bikos of di good tins,

27
00:01:22,220 --> 00:01:25,100
but na bikos yu wey bi ordinary pesin,

28
00:01:25,100 --> 00:01:26,660
dey make mout sey,

29
00:01:26,660 --> 00:01:28,180
yu bi God.”

30
00:01:28,180 --> 00:01:30,540
Jesus ask dem,

31
00:01:30,540 --> 00:01:32,780
“Una law nor tok sey,

32
00:01:32,780 --> 00:01:33,460
I sey,

33
00:01:33,460 --> 00:01:34,640
‘Una bi gods?’

34
00:01:34,640 --> 00:01:38,160
If dem koll di pipol wey God send en word go meet,

35
00:01:38,160 --> 00:01:38,700
sey,

36
00:01:38,700 --> 00:01:41,960
‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange,

37
00:01:41,960 --> 00:01:47,640
Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey,

38
00:01:47,640 --> 00:01:49,740
Yu dey tok against God,

39
00:01:49,740 --> 00:01:50,860
bikos I sey,

40
00:01:50,860 --> 00:01:52,440
‘I bi God Pikin?’

41
00:01:52,440 --> 00:01:55,500
If I nor do di tins wey my Papa send mi,

42
00:01:55,500 --> 00:01:56,700
make una nor bilive mi.

43
00:01:56,700 --> 00:01:58,660
But if I dey do dem,

44
00:01:58,660 --> 00:02:00,380
even if una nor bilive mi,

45
00:02:00,380 --> 00:02:02,740
make una bilive di tins wey I dey do,

46
00:02:02,740 --> 00:02:05,140
so dat una go know and undastand sey,

47
00:02:05,140 --> 00:02:09,060
I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”

48
00:02:09,060 --> 00:02:11,380
So dem try again to katch am,

49
00:02:11,380 --> 00:02:13,320
but e kon waka leave dem.

50
00:02:13,320 --> 00:02:16,460
Jesus go back kon cross Jordan River,

51
00:02:16,460 --> 00:02:20,180
where John for baptize pipol and e kon stay for der.

52
00:02:20,180 --> 00:02:22,740
Many pipol kom meet Jesus for di place.

53
00:02:22,740 --> 00:02:23,940
Dem bigin dey sey,

54
00:02:23,940 --> 00:02:27,060
“Even doh John nor do any mirakle,

55
00:02:27,060 --> 00:02:29,700
but evritin wey e tok about Jesus,

56
00:02:29,700 --> 00:02:30,880
na true.”

57
00:02:30,880 --> 00:02:35,900
And many pipol for di place kon bilive Jesus.

