﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,020
“If una love mi,

2
00:00:07,020 --> 00:00:08,480
una go do wetin I tok.

3
00:00:08,480 --> 00:00:16,200
Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever.

4
00:00:16,200 --> 00:00:18,540
Naim bi di Spirit wey dey tok trut,

5
00:00:18,540 --> 00:00:21,580
wey pipol for dis world nor go fit receive,

6
00:00:21,580 --> 00:00:24,300
bikos dem nor fit si am or know am,

7
00:00:24,300 --> 00:00:25,460
but una know am,

8
00:00:25,460 --> 00:00:27,760
bikos e dey stay inside una.

9
00:00:27,760 --> 00:00:31,720
I nor go leave una like pikin wey nor get papa and mama,

10
00:00:31,720 --> 00:00:33,400
bikos I go kom meet una again.

11
00:00:33,400 --> 00:00:34,980
Afta sometaim,

12
00:00:34,980 --> 00:00:37,900
di pipol for dis world nor go si mi,

13
00:00:37,900 --> 00:00:41,020
but una go si mi and bikos I dey alive,

14
00:00:41,020 --> 00:00:42,280
una go dey alive too.

15
00:00:42,280 --> 00:00:45,720
Dat time,

16
00:00:45,720 --> 00:00:50,200
una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi,

17
00:00:50,200 --> 00:00:51,400
as I dey inside una.

18
00:00:51,400 --> 00:00:54,700
Anybody wey hear and do wetin I tok,

19
00:00:54,700 --> 00:00:55,700
love mi.

20
00:00:55,700 --> 00:00:57,140
Di pesin wey love mi,

21
00:00:57,140 --> 00:01:01,440
mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”

22
00:01:01,440 --> 00:01:06,160
Judas (dis nor bi Judas Iskariot) kon sey,

23
00:01:06,160 --> 00:01:07,360
“Oga God,

24
00:01:07,360 --> 00:01:12,360
why yu won show yorsef give us and yu nor won show oda pipol for di world?”

25
00:01:12,360 --> 00:01:14,460
Jesus ansa am,

26
00:01:14,460 --> 00:01:16,500
“Anybody wey love mi,

27
00:01:16,500 --> 00:01:19,840
go do wetin I tok and my Papa go love am,

28
00:01:19,840 --> 00:01:22,000
den wi go kon meet and stay with am.

29
00:01:22,000 --> 00:01:23,960
Di pesin wey nor love mi,

30
00:01:23,960 --> 00:01:25,660
nor go do wetin I tok.

31
00:01:25,660 --> 00:01:28,540
Wetin una dey hear so nor bi my word,

32
00:01:28,540 --> 00:01:29,760
but na my Papa own.

33
00:01:29,760 --> 00:01:33,220
“I don dey tell una all dis tins since I dey with una.

34
00:01:33,220 --> 00:01:36,440
But di pesin wey go help una na di Holy Spirit,

35
00:01:36,440 --> 00:01:38,860
wey my Papa go send kom for my name.

36
00:01:38,860 --> 00:01:44,760
E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.

37
00:01:44,760 --> 00:01:47,060
Make una mind rest,

38
00:01:47,060 --> 00:01:49,480
bikos na my peace I give una.

39
00:01:49,480 --> 00:01:52,600
My peace difren from di one wey di world dey give.

40
00:01:52,600 --> 00:01:56,040
Make una nor fear or allow anytin worry una mind.

41
00:01:56,040 --> 00:01:58,140
“Una remember wen I tell una sey,

42
00:01:58,140 --> 00:02:01,520
‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’

43
00:02:01,520 --> 00:02:02,860
If una love mi,

44
00:02:02,860 --> 00:02:05,140
una go happy wen I tok sey,

45
00:02:05,140 --> 00:02:07,020
‘I dey go meet my Papa’,

46
00:02:07,020 --> 00:02:08,740
bikos my Papa big pass mi.

47
00:02:08,740 --> 00:02:11,820
I don tell una naw before e happen,

48
00:02:11,820 --> 00:02:13,220
so dat wen e happen,

49
00:02:13,220 --> 00:02:14,120
una go bilive mi.

50
00:02:14,120 --> 00:02:16,220
I nor go tok too mush naw,

51
00:02:16,220 --> 00:02:18,740
bikos di devil wey dey rule dis world,

52
00:02:18,740 --> 00:02:21,340
dey kom and e nor get pawa for my body.

53
00:02:21,340 --> 00:02:24,140
Since I dey do wetin my Papa tell mi,

54
00:02:24,140 --> 00:02:26,940
di world go know sey I love my Papa.

55
00:02:26,940 --> 00:02:31,580
“So make una get up make wi dey go.

