﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:10,240
“Na mi bi di korrect vine and na my Papa bi di gardina.

2
00:00:10,240 --> 00:00:18,260
E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit,

3
00:00:18,260 --> 00:00:20,220
so dat e go bear more fruit.

4
00:00:20,220 --> 00:00:22,320
Una dey klean already,

5
00:00:22,320 --> 00:00:24,560
bikos of di word wey I tell una.

6
00:00:24,560 --> 00:00:26,680
Make una dey inside mi,

7
00:00:26,680 --> 00:00:29,020
so dat I go dey inside una too.

8
00:00:29,020 --> 00:00:35,160
As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine,

9
00:00:35,160 --> 00:00:37,520
na so una nor go fit bear fruit,

10
00:00:37,520 --> 00:00:39,460
unless una dey inside mi.

11
00:00:39,460 --> 00:00:43,860
“Na mi bi di vine and na una bi di branches dem.

12
00:00:43,860 --> 00:00:47,440
Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am,

13
00:00:47,440 --> 00:00:48,980
go bear plenty fruit,

14
00:00:48,980 --> 00:00:50,420
bikos without mi,

15
00:00:50,420 --> 00:00:52,040
una nor go fit do anytin.

16
00:00:52,040 --> 00:00:54,780
Anybody wey nor stay inside mi,

17
00:00:54,780 --> 00:00:58,520
go dry and pipol go gada en branches dem,

18
00:00:58,520 --> 00:01:00,180
trow and burn dem inside fire.

19
00:01:00,180 --> 00:01:03,880
If una stay inside mi and my word dey inside una,

20
00:01:03,880 --> 00:01:05,520
anytin wey una ask,

21
00:01:05,520 --> 00:01:07,280
I go do am for una.

22
00:01:07,280 --> 00:01:11,360
My Papa go get big honor if una bear plenty fruit,

23
00:01:11,360 --> 00:01:14,280
wey go show sey una bi my disciples.

24
00:01:14,280 --> 00:01:16,720
“As my Papa love mi,

25
00:01:16,720 --> 00:01:18,280
na so I love una too,

26
00:01:18,280 --> 00:01:23,100
so make una live di kind life wey go let mi fit love una more-more.

27
00:01:23,100 --> 00:01:24,800
If una do wetin I tok,

28
00:01:24,800 --> 00:01:26,040
I go love una,

29
00:01:26,040 --> 00:01:29,560
just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.

30
00:01:29,560 --> 00:01:31,920
I don tell una all dis tins,

31
00:01:31,920 --> 00:01:36,780
so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.

32
00:01:36,780 --> 00:01:40,300
Dis na di kommand wey I give una sey,

33
00:01:40,300 --> 00:01:43,820
‘Make una love each oda di way I love una.’

34
00:01:43,820 --> 00:01:49,380
E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend.

35
00:01:49,380 --> 00:01:53,080
Una go bi my friend if una do wetin I tok.

36
00:01:53,080 --> 00:01:55,280
I nor go koll una savant again,

37
00:01:55,280 --> 00:01:59,160
bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do,

38
00:01:59,160 --> 00:02:01,160
but I dey koll una my friend,

39
00:02:01,160 --> 00:02:05,020
bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.

40
00:02:05,020 --> 00:02:06,580
Nor bi una choose mi,

41
00:02:06,580 --> 00:02:08,000
but na mi choose una.

42
00:02:08,000 --> 00:02:09,320
Bikos of dat,

43
00:02:09,320 --> 00:02:13,600
I don give una pawa to bear fruit wey go last,

44
00:02:13,600 --> 00:02:17,240
so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.

45
00:02:17,240 --> 00:02:18,840
Wetin I dey tell una bi sey,

46
00:02:18,840 --> 00:02:20,900
‘Make una love each oda.’ ”

