﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,640
“If pipol for dis world hate una,

2
00:00:07,640 --> 00:00:11,600
make una remember sey na mi dem first hate.

3
00:00:11,600 --> 00:00:14,460
If una bi friend with di pipol for dis world,

4
00:00:14,460 --> 00:00:16,700
dem go love una as dia own pipol.

5
00:00:16,700 --> 00:00:18,540
But una nor bi dia friend,

6
00:00:18,540 --> 00:00:21,100
bikos I don choose una from di world,

7
00:00:21,100 --> 00:00:22,920
naim make dem nor like una.

8
00:00:22,920 --> 00:00:25,540
Make una remember wetin I tell una,

9
00:00:25,540 --> 00:00:28,600
‘Savant nor dey big pass en oga.’

10
00:00:28,600 --> 00:00:30,080
If dem sofa mi,

11
00:00:30,080 --> 00:00:32,240
den dem go sofa una too.

12
00:00:32,240 --> 00:00:34,780
If to sey dem obey my word,

13
00:00:34,780 --> 00:00:36,560
dem go obey una own too.

14
00:00:36,560 --> 00:00:39,260
Since dem nor know di Pesin wey send mi kom,

15
00:00:39,260 --> 00:00:43,360
dem go do all dis tins to una bikos of my name.

16
00:00:43,360 --> 00:00:46,020
If to sey I nor kom tok to dem,

17
00:00:46,020 --> 00:00:48,980
dem for nor dey guilty for dia sin.

18
00:00:48,980 --> 00:00:49,820
But naw,

19
00:00:49,820 --> 00:00:52,500
dem nor get any eskuse for dia sin.

20
00:00:52,500 --> 00:00:54,640
Di pesin wey hate mi,

21
00:00:54,640 --> 00:00:56,100
hate my Papa too.

22
00:00:56,100 --> 00:00:59,260
If to sey dem nor si di mirakle wey I do,

23
00:00:59,260 --> 00:01:01,460
wey nobody don do before,

24
00:01:01,460 --> 00:01:03,740
dem for nor dey guilty for dia sin.

25
00:01:03,740 --> 00:01:06,060
But afta dem don si di mirakles,

26
00:01:06,060 --> 00:01:07,860
dem still hate mi and my Papa.

27
00:01:07,860 --> 00:01:09,820
All dis tins happen,

28
00:01:09,820 --> 00:01:11,620
so dat wetin God law tok,

29
00:01:11,620 --> 00:01:12,700
go bi true sey,

30
00:01:12,700 --> 00:01:15,240
‘Dem nor get rizin to take hate mi.’

31
00:01:15,240 --> 00:01:19,860
“But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom,

32
00:01:19,860 --> 00:01:21,520
e go tok about mi.

33
00:01:21,520 --> 00:01:23,660
And unasef go tok about mi,

34
00:01:23,660 --> 00:01:28,620
bikos una dey with mi from di biginnin.”

35
00:01:28,620 --> 00:01:31,080
“I dey tell una all dis tins,

36
00:01:31,080 --> 00:01:33,220
so dat nobody go fit deceive una.

37
00:01:33,220 --> 00:01:39,440
Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una,

38
00:01:39,440 --> 00:01:41,180
go tink sey e dey do God work.

39
00:01:41,180 --> 00:01:43,260
Dem go do all dis tins,

40
00:01:43,260 --> 00:01:45,540
bikos dem nor know mi and my Papa.

41
00:01:45,540 --> 00:01:48,180
But I tell una all dis tins,

42
00:01:48,180 --> 00:01:50,460
so dat wen di time rish,

43
00:01:50,460 --> 00:01:54,380
una go remember sey I tell una about dem before.

44
00:01:54,380 --> 00:01:56,980
I just dey tell una all dis tins,

45
00:01:56,980 --> 00:01:58,940
bikos I dey with una since.

