﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,000
“Naw,

2
00:00:06,000 --> 00:00:08,600
I dey go meet di Pesin wey send mi kom,

3
00:00:08,600 --> 00:00:10,240
but una dey ask mi,

4
00:00:10,240 --> 00:00:11,360
‘Where yu dey go?’

5
00:00:11,360 --> 00:00:14,800
But una nor happy as I dey tell una all dis tins.

6
00:00:14,800 --> 00:00:16,340
I tell una true word,

7
00:00:16,340 --> 00:00:19,480
na for una own good naim make mi won go,

8
00:00:19,480 --> 00:00:21,080
bikos if I nor go,

9
00:00:21,080 --> 00:00:24,080
di Pesin wey go help una nor go kom,

10
00:00:24,080 --> 00:00:25,160
but if I go,

11
00:00:25,160 --> 00:00:26,980
I go send am kom meet una.

12
00:00:26,980 --> 00:00:28,920
Wen e kom,

13
00:00:28,920 --> 00:00:32,400
e go show pipol for dis world wetin sin,

14
00:00:32,400 --> 00:00:34,840
God raitiousness and God judgement,

15
00:00:34,840 --> 00:00:35,380
bi.

16
00:00:35,380 --> 00:00:39,400
Di Spirit go show dem sey dem dey wrong about sin,

17
00:00:39,400 --> 00:00:41,460
bikos dem nor bilive mi.

18
00:00:41,460 --> 00:00:44,120
Dem dey wrong about God raitiousness,

19
00:00:44,120 --> 00:00:47,480
bikos I dey go meet my Papa and dem nor go si mi again.

20
00:00:47,480 --> 00:00:49,900
And dem dey wrong about judgement,

21
00:00:49,900 --> 00:00:53,540
bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.

22
00:00:53,540 --> 00:00:56,640
“I get plenty tins wey I won tell una,

23
00:00:56,640 --> 00:00:58,720
but una nor go fit bear dem naw.

24
00:00:58,720 --> 00:01:00,800
But wen God Spirit kom,

25
00:01:00,800 --> 00:01:02,680
e go show una di trut.

26
00:01:02,680 --> 00:01:04,540
E nor go tok wetin dey en mind,

27
00:01:04,540 --> 00:01:09,300
but e go tok wetin e hear from God and wetin go happen afta I don go.

28
00:01:09,300 --> 00:01:14,480
E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi.

29
00:01:14,480 --> 00:01:16,500
Evritin wey my Papa get,

30
00:01:16,500 --> 00:01:17,500
na my own,

31
00:01:17,500 --> 00:01:21,880
naim make mi tok sey di Spirit go tell una wetin e dey hear from mi.

32
00:01:21,880 --> 00:01:24,940
“Time go soon kom wen una nor go si mi,

33
00:01:24,940 --> 00:01:26,280
but afta sometaim,

34
00:01:26,280 --> 00:01:27,360
una go si mi.”

35
00:01:27,360 --> 00:01:30,760
Den some among di disciple kon dey ask each oda,

36
00:01:30,760 --> 00:01:33,080
“Wetin e mean wen e sey,

37
00:01:33,080 --> 00:01:35,700
‘Time go soon kom wen una nor go si mi,

38
00:01:35,700 --> 00:01:37,240
but afta sometaim,

39
00:01:37,240 --> 00:01:40,380
una go si mi bikos I dey go meet my Papa?’ ”

40
00:01:40,380 --> 00:01:42,540
Some still sey,

41
00:01:42,540 --> 00:01:45,000
“Wetin e get for mind wen e sey,

42
00:01:45,000 --> 00:01:46,560
‘Time go soon kom?’

43
00:01:46,560 --> 00:01:48,920
Wi nor undastand wetin e dey tok.”

44
00:01:48,920 --> 00:01:52,440
Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem,

45
00:01:52,440 --> 00:01:54,260
naim e ask dem,

46
00:01:54,260 --> 00:01:57,480
“Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey,

47
00:01:57,480 --> 00:02:00,560
‘Time go soon kom wen una nor go si mi,

48
00:02:00,560 --> 00:02:01,920
but afta sometaim,

49
00:02:01,920 --> 00:02:03,040
una go si mi?’

50
00:02:03,040 --> 00:02:04,800
I tell una true word,

51
00:02:04,800 --> 00:02:06,880
una go kry and mourn,

52
00:02:06,880 --> 00:02:08,660
but di world go dey happy;

53
00:02:08,660 --> 00:02:10,660
una go dey sad well-well,

54
00:02:10,660 --> 00:02:13,600
but una sadnes go turn to happiness.

55
00:02:13,600 --> 00:02:16,180
Wen woman won born pikin,

56
00:02:16,180 --> 00:02:18,400
e dey sofa strong pain,

57
00:02:18,400 --> 00:02:20,760
bikos en time to born don rish,

58
00:02:20,760 --> 00:02:22,160
but wen e don born,

59
00:02:22,160 --> 00:02:26,080
e go happy and e nor go remember di pain again,

60
00:02:26,080 --> 00:02:28,280
bikos e go si sey e don born pikin.

61
00:02:28,280 --> 00:02:30,040
Na so e bi for una naw,

62
00:02:30,040 --> 00:02:32,640
bikos una heart dey heavy,

63
00:02:32,640 --> 00:02:35,520
but I go si una again and for dat time,

64
00:02:35,520 --> 00:02:39,820
una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.

65
00:02:39,820 --> 00:02:41,640
By dat time,

66
00:02:41,640 --> 00:02:44,560
una nor go ask mi anytin again.

67
00:02:44,560 --> 00:02:46,480
I tell una true word sey,

68
00:02:46,480 --> 00:02:49,000
anytin wey una ask my Papa with my name,

69
00:02:49,000 --> 00:02:50,580
E go give una.

70
00:02:50,580 --> 00:02:52,240
Before naw,

71
00:02:52,240 --> 00:02:55,640
una neva take my name ask for anytin.

72
00:02:55,640 --> 00:03:02,440
Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am,

73
00:03:02,440 --> 00:03:05,640
so dat una joy go full well-well.

74
00:03:05,640 --> 00:03:08,720
“Since I dey use parabol tok to una;

75
00:03:08,720 --> 00:03:11,920
but di time dey kom wen I nor go use parabol again,

76
00:03:11,920 --> 00:03:16,320
but I go tell una about my Papa for di way wey una go undastand.

77
00:03:16,320 --> 00:03:17,880
By dat time,

78
00:03:17,880 --> 00:03:22,000
una go fit ask anytin with my name and God go do am for una.

79
00:03:22,000 --> 00:03:23,800
My Papa love una,

80
00:03:23,800 --> 00:03:27,680
bikos una love mi and bilive sey na-im send mi.

81
00:03:27,680 --> 00:03:30,200
Na my Papa send mi kom dis world,

82
00:03:30,200 --> 00:03:30,920
but naw,

83
00:03:30,920 --> 00:03:32,920
I dey go back go meet am.”

84
00:03:32,920 --> 00:03:35,320
En disciples kon sey,

85
00:03:35,320 --> 00:03:36,440
“Yu si,

86
00:03:36,440 --> 00:03:42,020
na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol.

87
00:03:42,020 --> 00:03:49,040
Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon.

88
00:03:49,040 --> 00:03:50,160
Bikos of dis,

89
00:03:50,160 --> 00:03:53,320
wi bilive sey na God send yu kom.”

90
00:03:53,320 --> 00:03:55,760
Jesus kon tell dem,

91
00:03:55,760 --> 00:03:57,880
“So una don bilive naw?

92
00:03:57,880 --> 00:03:58,880
Look,

93
00:03:58,880 --> 00:04:01,280
di time dey kom and e don even rish,

94
00:04:01,280 --> 00:04:07,040
wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone.

95
00:04:07,040 --> 00:04:08,360
But I nor dey alone,

96
00:04:08,360 --> 00:04:10,100
bikos my Papa dey with mi.

97
00:04:10,100 --> 00:04:12,720
“I don tell una all dis tins,

98
00:04:12,720 --> 00:04:15,360
so dat my peace go stay with una.

99
00:04:15,360 --> 00:04:18,900
Wahala full inside di world and sofa dey too,

100
00:04:18,900 --> 00:04:21,220
but make una heart dey strong,

101
00:04:21,220 --> 00:04:25,040
bikos I don already win di world.”

