﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,200
As Jesus karry en cross dey go,

2
00:00:07,200 --> 00:00:14,200
e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.)

3
00:00:14,200 --> 00:00:15,080
For der,

4
00:00:15,080 --> 00:00:17,200
dem kon nail Jesus for cross.

5
00:00:17,200 --> 00:00:19,840
Dem still nail two oda pipol for cross,

6
00:00:19,840 --> 00:00:22,920
one for en rite and di oda for en left.

7
00:00:22,920 --> 00:00:27,720
Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jesus cross,

8
00:00:27,720 --> 00:00:28,800
wey sey,

9
00:00:28,800 --> 00:00:31,680
“dis na Jesus wey kom from Nazaret,

10
00:00:31,680 --> 00:00:33,500
wey bi di Jew pipol king.”

11
00:00:33,500 --> 00:00:36,200
Since di place where dem kill Jesus near town,

12
00:00:36,200 --> 00:00:40,160
many of di Jew pipol wey dey for Jerusalem kom read di sign-board,

13
00:00:40,160 --> 00:00:43,280
bikos dem rite am for three language wey bi Aramaik,

14
00:00:43,280 --> 00:00:44,620
Latin and Greek.

15
00:00:44,620 --> 00:00:46,720
Den di shief priests kon tell Pilate,

16
00:00:46,720 --> 00:00:49,400
“Make yu nor rite sey,

17
00:00:49,400 --> 00:00:50,920
dis na Jew pipol king,

18
00:00:50,920 --> 00:00:52,440
but rite sey,

19
00:00:52,440 --> 00:00:53,920
dis man sey,

20
00:00:53,920 --> 00:00:55,440
‘I bi Jew pipol king.’ ”

21
00:00:55,440 --> 00:00:57,560
But Pilate ansa dem,

22
00:00:57,560 --> 00:01:00,040
“Wetin I don rite finish,

23
00:01:00,040 --> 00:01:01,920
na so e go bi.”

24
00:01:01,920 --> 00:01:04,600
Wen di sojas don nail Jesus for cross,

25
00:01:04,600 --> 00:01:08,000
dem tear en klot and dem for kon divide am.

26
00:01:08,000 --> 00:01:12,600
But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am,

27
00:01:12,600 --> 00:01:14,940
since dem weave-am from top go rish bottom).

28
00:01:14,940 --> 00:01:17,160
So di sojas tell each oda sey,

29
00:01:17,160 --> 00:01:19,120
“Make wi nor tear am,

30
00:01:19,120 --> 00:01:22,560
but make wi gambol to si who go take am.”

31
00:01:22,560 --> 00:01:24,080
Dis tin happen to show sey,

32
00:01:24,080 --> 00:01:27,120
wetin dem rite for God word na true sey,

33
00:01:27,120 --> 00:01:29,860
“Dem go divide my klot,

34
00:01:29,860 --> 00:01:31,720
afta dem don gambol for am.”

35
00:01:31,720 --> 00:01:31,780
Dis na wetin di sojas kon do.

36
00:01:31,780 --> 00:01:33,660
By dis time,

37
00:01:33,660 --> 00:01:37,160
di only pipol wey stand near di cross where dem nail Jesus,

38
00:01:37,160 --> 00:01:38,400
na-im mama;

39
00:01:38,400 --> 00:01:39,300
en aunty,

40
00:01:39,300 --> 00:01:42,580
Mary wey bi Klopas wife and Mary Magdalin.

41
00:01:42,580 --> 00:01:44,760
So wen Jesus si en mama and John,

42
00:01:44,760 --> 00:01:47,580
di disciple wey e love well-well stand for der,

43
00:01:47,580 --> 00:01:49,280
e kon tell en mama,

44
00:01:49,280 --> 00:01:52,540
“Mama,

45
00:01:52,540 --> 00:01:54,800
look,

46
00:01:54,800 --> 00:02:00,600
dis na yor pikin.”

47
00:02:00,600 --> 00:02:04,440
Den e tell di disciple,

48
00:02:04,440 --> 00:02:08,720
“Make yu look,

49
00:02:08,720 --> 00:02:13,260
dis na yor mama.”

50
00:02:13,260 --> 00:02:15,740
From dat time,

51
00:02:15,740 --> 00:02:18,520
di disciple kon take Jesus mama go en own house.

52
00:02:18,520 --> 00:02:22,920
Wen Jesus si sey evritin don finish,

53
00:02:22,920 --> 00:02:29,040
e kon sey,

54
00:02:29,040 --> 00:02:39,740
“Wota dey hongry mi”,

55
00:02:39,740 --> 00:02:42,000
(dis show sey wetin God tok,

56
00:02:42,000 --> 00:02:42,960
really happen).

57
00:02:42,960 --> 00:02:45,880
Di sojas soak sponge inside wine wey betta,

58
00:02:45,880 --> 00:02:54,120
wey dey one kontaina for der kon put am for di branches of one plant wey dem dey koll hyssop kon stresh am put for Jesus mout.

59
00:02:54,120 --> 00:02:55,760
Wen e don taste di wine,

60
00:02:55,760 --> 00:02:59,160
Jesus kon sey,

61
00:02:59,160 --> 00:03:20,160
“Evritin don finish.”

62
00:03:20,160 --> 00:03:21,660
Den e bend en head down,

63
00:03:21,660 --> 00:03:23,260
kon die.

64
00:03:23,260 --> 00:03:31,780
Dis tin happen for di day wen dem dey prepare for di Passova Feast and bikos dem nor wont make di dead body dem stay for cross for Sabat Day,

65
00:03:31,780 --> 00:03:34,760
(bikos dat Sabat Day na special one for dem),

66
00:03:34,760 --> 00:03:38,320
di Jew oga dem kon tell Pilate make dem break dia leg,

67
00:03:38,320 --> 00:03:39,960
to make sure sey dem don die,

68
00:03:39,960 --> 00:03:43,280
so dat dem go fit bring dia dead body kom down.

69
00:03:43,280 --> 00:03:47,900
So di sojas break di oda two pipol leg wey dem kill with Jesus.

70
00:03:47,900 --> 00:03:52,800
But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die,

71
00:03:52,800 --> 00:03:54,380
dem nor kon break en leg.

72
00:03:54,380 --> 00:03:57,920
But one soja kon take spear shuk di korna of en belle,

73
00:03:57,920 --> 00:04:01,100
den blood and wota kon dey rush kom out.

74
00:04:01,100 --> 00:04:03,600
All dis story na true,

75
00:04:03,600 --> 00:04:06,720
(bikos na di pesin wey si dem happen,

76
00:04:06,720 --> 00:04:10,080
naim tok about dem and wetin e tok na true),

77
00:04:10,080 --> 00:04:12,220
so dat una go fit bilive.

78
00:04:12,220 --> 00:04:14,320
All dis tin happen to show sey,

79
00:04:14,320 --> 00:04:17,100
wetin dem rite for God word na true sey,

80
00:04:17,100 --> 00:04:21,300
“Dem nor go break one singol bone for en body.”

81
00:04:21,300 --> 00:04:23,260
And God word still sey,

82
00:04:23,260 --> 00:04:29,300
“Dem go stand dey sopraiz as dem dey look di pesin wey dem shuk en body.”

