﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,460
Afta dis time,

2
00:00:06,460 --> 00:00:08,980
Josef wey kom from Arimatea,

3
00:00:08,980 --> 00:00:11,100
wey bi Jesus sekret disciple,

4
00:00:11,100 --> 00:00:14,180
(bikos e dey fear di oda Jew oga dem),

5
00:00:14,180 --> 00:00:18,760
kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der.

6
00:00:18,760 --> 00:00:22,980
Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.

7
00:00:22,980 --> 00:00:24,380
Nikodimos,

8
00:00:24,380 --> 00:00:26,960
di man wey hide go si Jesus for nite,

9
00:00:26,960 --> 00:00:28,560
kon follow Josef.

10
00:00:28,560 --> 00:00:32,360
E karry perfume wey heavy rish seventy-five pounds,

11
00:00:32,360 --> 00:00:34,900
wey dem take myrrh and aloe spice make.

12
00:00:34,900 --> 00:00:44,100
Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri.

13
00:00:44,100 --> 00:00:53,540
One gardin dey near di place where dem kill Jesus and one new grave wey dem neva beri anybody put before,

14
00:00:53,540 --> 00:00:54,120
dey inside di gardin.

15
00:00:54,120 --> 00:01:01,900
Since dat day na di day wey Jew pipol dey prepare for di Passova Feast and bikos di new grave dey near der,

16
00:01:01,900 --> 00:01:06,300
dem kon beri Jesus inside di grave.

17
00:01:06,300 --> 00:01:08,400
For di first day for di week,

18
00:01:08,400 --> 00:01:10,760
wen day neva break well,

19
00:01:10,760 --> 00:01:13,200
Mary Magdalin kon go where di grave dey.

20
00:01:13,200 --> 00:01:17,000
E si sey dem don remove di stone wey dem take kover di grave mout.

21
00:01:17,000 --> 00:01:21,080
Den e run go meet Simon Pita and John kon tell dem,

22
00:01:21,080 --> 00:01:32,480
“Somebody don karry Jesus body komot from di grave and wi nor know where dem put am.”

23
00:01:32,480 --> 00:01:36,940
So Pita and John kon go where di grave dey.

24
00:01:36,940 --> 00:01:39,160
Di two of dem kon dey run togeda,

25
00:01:39,160 --> 00:01:42,960
but John run pass Pita kon first am rish di grave.

26
00:01:42,960 --> 00:01:45,080
E nor enter inside di grave,

27
00:01:45,080 --> 00:01:50,680
but e bend down kon si di linen klot wey dem take wrap Jesus body for groun inside di grave.

28
00:01:50,680 --> 00:01:52,720
Wen Simon Pita rish der,

29
00:01:52,720 --> 00:01:55,900
e enter inside di grave kon si di linen klot for groun too.

30
00:01:55,900 --> 00:02:01,040
But di small klot wey dey for Jesus head nor dey for di same place where di oda klot dey,

31
00:02:01,040 --> 00:02:03,360
e dey on en own for one korna.

32
00:02:03,360 --> 00:02:08,020
Den John kon enter inside and wetin e si kon make am bilive.

33
00:02:08,020 --> 00:02:10,960
(Bikos dem undastand God word wey sey,

34
00:02:10,960 --> 00:02:12,880
Jesus go wake-up afta e die).

35
00:02:12,880 --> 00:02:15,960
So di two disciple kon go back to dia house.

36
00:02:15,960 --> 00:02:19,340
But Mary stand for outside di grave dey kry.

37
00:02:19,340 --> 00:02:20,400
As e still dey kry,

38
00:02:20,400 --> 00:02:23,080
e kon bend down look inside di grave.

39
00:02:23,080 --> 00:02:28,200
Den e si two angel wey wear white klot sidan for where dem put Jesus body.

40
00:02:28,200 --> 00:02:32,700
One dey for where di head dey and di oda dey for where di leg dey.

41
00:02:32,700 --> 00:02:34,140
Dem kon ask am,

42
00:02:34,140 --> 00:02:35,760
“Woman,

43
00:02:35,760 --> 00:02:37,520
why yu dey kry?”

44
00:02:37,520 --> 00:02:38,560
Mary ansa,

45
00:02:38,560 --> 00:02:48,040
“Dem don karry my oga komot and I nor know where dem karry am go.”

46
00:02:48,040 --> 00:02:49,400
Afta e tok finish,

47
00:02:49,400 --> 00:02:52,420
e turn round kon si Jesus stand for der,

48
00:02:52,420 --> 00:02:55,120
but e nor know sey na Jesus bi dat.

49
00:02:55,120 --> 00:02:56,360
Jesus tell am,

50
00:02:56,360 --> 00:02:58,680
“Woman,

51
00:02:58,680 --> 00:03:00,640
why yu dey kry?

52
00:03:00,640 --> 00:03:03,240
Na who yu dey find?”

53
00:03:03,240 --> 00:03:06,000
Bikos Mary tink sey naim bi di gardina,

54
00:03:06,000 --> 00:03:06,960
e kon sey,

55
00:03:06,960 --> 00:03:11,100
“Oga God,

56
00:03:11,100 --> 00:03:14,360
if na yu karry am komot,

57
00:03:14,360 --> 00:03:18,280
make yu tell mi where yu karry am go,

58
00:03:18,280 --> 00:03:22,180
so dat I go-go karry am.”

59
00:03:22,180 --> 00:03:25,720
Den Jesus koll am,

60
00:03:25,720 --> 00:03:27,720
“Mary.”

61
00:03:27,720 --> 00:03:28,720
So,

62
00:03:28,720 --> 00:03:33,640
Mary turn round face am kon koll am for Hibru language,

63
00:03:33,640 --> 00:03:37,880
“Raboni!”

64
00:03:37,880 --> 00:03:40,520
(wey mean Tisha).

65
00:03:40,520 --> 00:03:42,280
Jesus ansa am,

66
00:03:42,280 --> 00:03:44,400
“Make yu neva tosh mi,

67
00:03:44,400 --> 00:03:47,240
bikos I neva go meet my Papa for heaven.

68
00:03:47,240 --> 00:03:48,720
Go meet my brodas,

69
00:03:48,720 --> 00:03:49,840
tell dem sey,

70
00:03:49,840 --> 00:03:51,920
‘I dey go heaven go meet my Papa,

71
00:03:51,920 --> 00:03:53,320
wey bi yor Papa too;

72
00:03:53,320 --> 00:03:54,840
my God,

73
00:03:54,840 --> 00:03:56,820
wey bi yor God too.’ ”

74
00:03:56,820 --> 00:04:00,880
Den Mary Magdalin go meet di disciples for where dem dey kon tell dem,

75
00:04:00,880 --> 00:04:04,200
“I don si di Oga God!”

76
00:04:04,200 --> 00:04:07,380
Den e tell dem wetin Jesus tell am.

