﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,920
Afta dis,

2
00:00:06,920 --> 00:00:10,840
Jesus show ensef again to en disciples near Tiberias Sea.

3
00:00:10,840 --> 00:00:12,620
Dis na how e do am.

4
00:00:12,620 --> 00:00:15,560
Simon Pita and Tomas (wey bi twins),

5
00:00:15,560 --> 00:00:18,700
with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee),

6
00:00:18,700 --> 00:00:22,460
with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples,

7
00:00:22,460 --> 00:00:23,960
kon gada togeda.

8
00:00:23,960 --> 00:00:25,740
Simon Pita kon tell dem,

9
00:00:25,740 --> 00:00:28,480
“I dey go katch fish.”

10
00:00:28,480 --> 00:00:29,280
Dem sey,

11
00:00:29,280 --> 00:00:31,760
“Wi too go follow yu go.”

12
00:00:31,760 --> 00:00:34,960
Den dem komot go enter one kenu.

13
00:00:34,960 --> 00:00:37,380
But dat nite dem nor katch any fish.

14
00:00:37,380 --> 00:00:39,360
Wen day break,

15
00:00:39,360 --> 00:00:41,120
Jesus stand for di wotaside,

16
00:00:41,120 --> 00:00:43,880
but di disciples nor know sey naim dey der.

17
00:00:43,880 --> 00:00:45,360
Jesus kon ask dem,

18
00:00:45,360 --> 00:00:47,240
“My shidren,

19
00:00:47,240 --> 00:00:49,720
una katch any fish?”

20
00:00:49,720 --> 00:00:51,120
Dem ansa,

21
00:00:51,120 --> 00:00:53,080
“No o-o.”

22
00:00:53,080 --> 00:00:54,840
E kon tell dem,

23
00:00:54,840 --> 00:01:00,700
“Make una trow una net go di rite side for di kenu and una go katch some fish.”

24
00:01:00,700 --> 00:01:03,200
Wen dem don trow dia net inside di river,

25
00:01:03,200 --> 00:01:06,520
dem nor fit draw am komot from di wota,

26
00:01:06,520 --> 00:01:07,640
bikos di fish wey dem katch,

27
00:01:07,640 --> 00:01:08,720
plenty well-well.

28
00:01:08,720 --> 00:01:09,520
Den,

29
00:01:09,520 --> 00:01:10,200
John,

30
00:01:10,200 --> 00:01:13,400
di disciple wey Jesus love kon tell Pita,

31
00:01:13,400 --> 00:01:15,840
“Dis man na Jesus o-o.”

32
00:01:15,840 --> 00:01:18,000
Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus,

33
00:01:18,000 --> 00:01:23,360
e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under),

34
00:01:23,360 --> 00:01:25,660
den e jump inside di river.

35
00:01:25,660 --> 00:01:26,960
By dis time,

36
00:01:26,960 --> 00:01:35,400
di oda disciples dey inside di kenu dey pul di net with di plenty fish go rish groun for di wotaside (bikos where dem dey,

37
00:01:35,400 --> 00:01:38,400
na about one hundred yard from di wotaside).

38
00:01:38,400 --> 00:01:40,840
Wen dem don kom down from di kenu,

39
00:01:40,840 --> 00:01:45,560
dem kon si shako fire with fish and some bread on-top am.

40
00:01:45,560 --> 00:01:46,840
Jesus tell dem,

41
00:01:46,840 --> 00:01:50,640
“Make una bring some for di fish wey una katch kom.”

42
00:01:50,640 --> 00:01:55,360
Den Simon Pita enter di kenu kon pul di net kom groun.

43
00:01:55,360 --> 00:02:01,320
Di net katch plenty big-big fish wey rish one hundred and fifty-three and di net nor tear.

44
00:02:01,320 --> 00:02:02,600
Jesus tell dem,

45
00:02:02,600 --> 00:02:05,760
“Make una kom chop.”

46
00:02:05,760 --> 00:02:06,840
But dem nor fit ask am,

47
00:02:06,840 --> 00:02:07,560
“Who yu bi”,

48
00:02:07,560 --> 00:02:10,120
bikos dem bilive sey na Jesus e bi.

49
00:02:10,120 --> 00:02:13,320
Den Jesus kon give dem bread and fish.

50
00:02:13,320 --> 00:02:16,920
Dis make am di third time wen Jesus show ensef to en disciples,

51
00:02:16,920 --> 00:02:19,820
afta e don raiz-up from grave.

52
00:02:19,820 --> 00:02:22,440
Wen dem don chop finish,

53
00:02:22,440 --> 00:02:25,920
Jesus ask Simon Pita,

54
00:02:25,920 --> 00:02:26,400
“Simon,

55
00:02:26,400 --> 00:02:27,880
John pikin,

56
00:02:27,880 --> 00:02:30,300
yu love mi pass all dis tins?”

57
00:02:30,300 --> 00:02:31,960
E ansa,

58
00:02:31,960 --> 00:02:33,000
“Yes,

59
00:02:33,000 --> 00:02:33,880
Oga God!

60
00:02:33,880 --> 00:02:36,160
Yu know sey I love yu.”

61
00:02:36,160 --> 00:02:37,620
Jesus kon tell am,

62
00:02:37,620 --> 00:02:40,580
“Make yu feed my sheep.”

63
00:02:40,580 --> 00:02:42,680
Jesus ask am again,

64
00:02:42,680 --> 00:02:44,040
“Simon,

65
00:02:44,040 --> 00:02:44,860
John pikin,

66
00:02:44,860 --> 00:02:47,800
yu really tink sey yu love mi?”

67
00:02:47,800 --> 00:02:49,520
Pita ansa,

68
00:02:49,520 --> 00:02:51,280
“Yes,

69
00:02:51,280 --> 00:02:52,400
oga!

70
00:02:52,400 --> 00:02:54,640
Yu know sey I love yu.”

71
00:02:54,640 --> 00:02:56,960
Jesus kon tell am,

72
00:02:56,960 --> 00:02:59,160
“Make yu kare for my sheep.”

73
00:02:59,160 --> 00:03:01,780
Jesus ask am di third time,

74
00:03:01,780 --> 00:03:03,060
“Simon,

75
00:03:03,060 --> 00:03:04,260
John pikin,

76
00:03:04,260 --> 00:03:07,000
yu sure sey yu love mi so?”

77
00:03:07,000 --> 00:03:08,660
Pita kon dey vex,

78
00:03:08,660 --> 00:03:10,440
bikos e pain am well-well,

79
00:03:10,440 --> 00:03:12,960
as Jesus ask am di same kweshon three times,

80
00:03:12,960 --> 00:03:15,360
“Yu sure sey yu love mi so?”

81
00:03:15,360 --> 00:03:16,400
Den Pita sey,

82
00:03:16,400 --> 00:03:18,020
“Oga God,

83
00:03:18,020 --> 00:03:19,720
yu know evritin,

84
00:03:19,720 --> 00:03:22,760
yu know sey I really love yu.”

85
00:03:22,760 --> 00:03:23,560
So,

86
00:03:23,560 --> 00:03:25,240
Jesus tell am,

87
00:03:25,240 --> 00:03:27,240
“Make yu feed my sheep.

88
00:03:27,240 --> 00:03:29,560
I tell yu true word,

89
00:03:29,560 --> 00:03:30,960
wen yu dey small,

90
00:03:30,960 --> 00:03:32,300
yu dey do as yu like,

91
00:03:32,300 --> 00:03:36,720
dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont,

92
00:03:36,720 --> 00:03:38,860
but wen yu go old,

93
00:03:38,860 --> 00:03:45,880
yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”

94
00:03:45,880 --> 00:03:49,040
(Jesus tok dis to show how Pita go die,

95
00:03:49,040 --> 00:03:50,700
so dat God go get honor).

96
00:03:50,700 --> 00:03:52,640
Afta Jesus tok finish,

97
00:03:52,640 --> 00:03:54,080
e kon tell Pita,

98
00:03:54,080 --> 00:03:55,820
“Make yu follow mi.”

99
00:03:55,820 --> 00:03:57,680
Wen Pita turn round,

100
00:03:57,680 --> 00:03:58,900
e kon si John,

101
00:03:58,900 --> 00:04:01,200
(di disciple wey Jesus love well-well),

102
00:04:01,200 --> 00:04:02,280
dey follow dem.

103
00:04:02,280 --> 00:04:07,440
(Dis na di disciple wey bend en head near Jesus chest wen dem dey chop kon ask am,

104
00:04:07,440 --> 00:04:08,360
“Oga God,

105
00:04:08,360 --> 00:04:10,800
who bi di pesin wey go sell yu give yor enemy?”)

106
00:04:10,800 --> 00:04:12,440
Wen Pita si am,

107
00:04:12,440 --> 00:04:13,760
e kon ask Jesus,

108
00:04:13,760 --> 00:04:14,940
“Oga God,

109
00:04:14,940 --> 00:04:16,600
wot about dis man?”

110
00:04:16,600 --> 00:04:17,840
Jesus ansa am,

111
00:04:17,840 --> 00:04:20,720
“Make yu mind yor own business.

112
00:04:20,720 --> 00:04:23,980
If I wont sey make e stay until I kom back,

113
00:04:23,980 --> 00:04:25,560
wish one koncern yu inside?

114
00:04:25,560 --> 00:04:27,800
Make yu yorsef follow mi.”

115
00:04:27,800 --> 00:04:31,640
Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey,

116
00:04:31,640 --> 00:04:34,240
di disciple nor go die.

117
00:04:34,240 --> 00:04:38,400
But Jesus nor really tell Pita sey di oda disciple nor go die,

118
00:04:38,400 --> 00:04:39,180
but e sey,

119
00:04:39,180 --> 00:04:42,040
“If I won sey make e stay until I kom back,

120
00:04:42,040 --> 00:04:44,280
wish one koncern yu inside?”

121
00:04:44,280 --> 00:04:51,560
Na dis bi di disciple wey bear witness about all dis tins and wey rite dem and wi know sey wetin e rite,

122
00:04:51,560 --> 00:04:52,620
na true.

123
00:04:52,620 --> 00:04:55,960
Jesus do many oda tins wey dem nor rite down.

124
00:04:55,960 --> 00:04:57,840
If to sey dem rite all of dem,

125
00:04:57,840 --> 00:05:00,680
di world nor go get space wey go kontain all di book,

126
00:05:00,680 --> 00:05:07,000
where dem rite dem put.

