﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,240
Wen Elizabet belle don rish six monts,

2
00:00:08,240 --> 00:00:10,840
God kon send angel Gabriel go Nazaret,

3
00:00:10,840 --> 00:00:12,760
one small town for Galilee,

4
00:00:12,760 --> 00:00:14,120
go meet Mary.

5
00:00:14,120 --> 00:00:19,020
Dis Mary neva ever sleep with man before and na-im Josef wey kom from David family,

6
00:00:19,020 --> 00:00:20,000
won marry.

7
00:00:20,000 --> 00:00:21,480
Di angel kon tell am,

8
00:00:21,480 --> 00:00:23,600
“I salot yu o-o!

9
00:00:23,600 --> 00:00:26,640
Yu wey God don favor,

10
00:00:26,640 --> 00:00:27,680
bikos E dey with yu.”

11
00:00:27,680 --> 00:00:29,280
But Mary dey fear,

12
00:00:29,280 --> 00:00:33,380
bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean.

13
00:00:33,380 --> 00:00:35,520
Den di angel tell am,

14
00:00:35,520 --> 00:00:37,440
“Make yu nor fear,

15
00:00:37,440 --> 00:00:38,280
Mary,

16
00:00:38,280 --> 00:00:40,280
bikos God don favor yu!

17
00:00:40,280 --> 00:00:41,420
Make yu listin,

18
00:00:41,420 --> 00:00:46,040
yu go get belle kon born boy and yu go name am,

19
00:00:46,040 --> 00:00:46,860
‘Jesus.’

20
00:00:46,860 --> 00:00:56,040
E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.

21
00:00:56,040 --> 00:01:01,340
Na-im go rule Jakob house forever and en kingdom nor go ever end.”

22
00:01:01,340 --> 00:01:03,360
Mary tell di angel,

23
00:01:03,360 --> 00:01:05,640
“How dis tins go fit happen,

24
00:01:05,640 --> 00:01:08,640
as e bi sey I neva sleep with man before?”

25
00:01:08,640 --> 00:01:10,480
Di angel ansa am,

26
00:01:10,480 --> 00:01:13,400
“Di Holy Spirit pawa go kover yu.

27
00:01:13,400 --> 00:01:16,120
So di pikin wey yu go born,

28
00:01:16,120 --> 00:01:19,400
go dey holy and dem go koll am God Pikin.

29
00:01:19,400 --> 00:01:19,800
Si,

30
00:01:19,800 --> 00:01:28,440
yor kousin Elizabet don get belle for six monts naw and e go born boy for en old age,

31
00:01:28,440 --> 00:01:30,760
even doh dem tok sey e nor go fit get belle.

32
00:01:30,760 --> 00:01:34,240
Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”

33
00:01:34,240 --> 00:01:35,480
Mary kon sey,

34
00:01:35,480 --> 00:01:37,160
“Yes,

35
00:01:37,160 --> 00:01:38,520
I bi God savant,

36
00:01:38,520 --> 00:01:40,160
make wetin yu tok so,

37
00:01:40,160 --> 00:01:42,120
happen to mi.”

38
00:01:42,120 --> 00:01:44,320
Den di angel kon leave am.

