﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,320
Den Jesus sey,

2
00:00:07,320 --> 00:00:09,760
“One man dey wey get two sons.

3
00:00:09,760 --> 00:00:12,280
Di yonga one kon tell en papa,

4
00:00:12,280 --> 00:00:15,220
‘Give mi my own share for awa propaty.’

5
00:00:15,220 --> 00:00:16,820
So en papa kon gi-am.

6
00:00:16,820 --> 00:00:18,620
“Afta sometaim,

7
00:00:18,620 --> 00:00:26,640
di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.

8
00:00:26,640 --> 00:00:29,800
Wen e don finish all wetin e get,

9
00:00:29,800 --> 00:00:31,900
e nor si anytin to chop,

10
00:00:31,900 --> 00:00:34,240
bikos honga dey for dat kountry,

11
00:00:34,240 --> 00:00:35,740
so e kon dey sofa.

12
00:00:35,740 --> 00:00:39,060
E kon dey work for one man for der,

13
00:00:39,060 --> 00:00:42,460
di man dey send am go en farm go give pig food.

14
00:00:42,460 --> 00:00:47,060
Di honga kon make am dey won chop di food wey di pig dem dey chop,

15
00:00:47,060 --> 00:00:48,940
bikos nobody gi-am food.

16
00:00:48,940 --> 00:00:52,080
“But wen en eye klear,

17
00:00:52,080 --> 00:00:53,160
e kon sey,

18
00:00:53,160 --> 00:00:58,680
‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish,

19
00:00:58,680 --> 00:01:01,480
but hongry don nearly kill mi for here!

20
00:01:01,480 --> 00:01:04,360
I go get up go meet my papa tell am,

21
00:01:04,360 --> 00:01:08,080
“Papa I don sin against heaven and against yu.

22
00:01:08,080 --> 00:01:11,340
I nor rish make dem koll mi yor pikin again.

23
00:01:11,340 --> 00:01:14,920
Make yu take mi as yor worker.” ’

24
00:01:14,920 --> 00:01:18,560
So e get up kon go meet en papa.

25
00:01:18,560 --> 00:01:21,640
“But wen en papa si am dey kom from far,

26
00:01:21,640 --> 00:01:22,660
e sorry for am,

27
00:01:22,660 --> 00:01:24,080
run go meet am,

28
00:01:24,080 --> 00:01:26,020
hold am near body kon kiss am.

29
00:01:26,020 --> 00:01:28,020
“Den di pikin tell am,

30
00:01:28,020 --> 00:01:29,420
‘Papa,

31
00:01:29,420 --> 00:01:32,660
I don sin against heaven and yu.

32
00:01:32,660 --> 00:01:35,640
I nor rish make dem koll mi yor pikin again.

33
00:01:35,640 --> 00:01:38,620
Make yu take mi as yor worker.’

34
00:01:38,620 --> 00:01:43,180
“But di papa koll en savants kon tell dem,

35
00:01:43,180 --> 00:01:45,400
‘Make una bring di best klot,

36
00:01:45,400 --> 00:01:48,600
ring and shoe and make una wear dem for my pikin.

37
00:01:48,600 --> 00:01:49,840
Den,

38
00:01:49,840 --> 00:01:52,480
make una go take di melu wey fat pass,

39
00:01:52,480 --> 00:01:54,420
kill-am make wi do party,

40
00:01:54,420 --> 00:01:57,260
bikos dis my pikin die before,

41
00:01:57,260 --> 00:01:58,200
but naw,

42
00:01:58,200 --> 00:02:00,280
e don kom back to life,

43
00:02:00,280 --> 00:02:01,360
e lost before,

44
00:02:01,360 --> 00:02:02,160
but naw,

45
00:02:02,160 --> 00:02:03,300
I don si am!’

46
00:02:03,300 --> 00:02:04,940
So di party kon start.

47
00:02:04,940 --> 00:02:06,600
“By dat time,

48
00:02:06,600 --> 00:02:10,980
di senior son dey kom from farm where e go work.

49
00:02:10,980 --> 00:02:12,580
Wen e don near house,

50
00:02:12,580 --> 00:02:15,660
e kon dey hear music and si pipol dey dance.

51
00:02:15,660 --> 00:02:18,760
So e koll one savant kon ask am,

52
00:02:18,760 --> 00:02:19,820
‘Wetin dey happen?’

53
00:02:19,820 --> 00:02:21,260
Di savant ansa,

54
00:02:21,260 --> 00:02:26,500
‘Yor broda don kom back and yor papa don kill di melu wey fat pass,

55
00:02:26,500 --> 00:02:30,480
bikos e kom back well and nor-tin bad happen to am.’

56
00:02:30,480 --> 00:02:35,220
“Di senior broda kon dey vex and e nor gri enter house,

57
00:02:35,220 --> 00:02:37,660
so en papa kon beg am make e enter.

58
00:02:37,660 --> 00:02:38,300
So,

59
00:02:38,300 --> 00:02:39,620
e tell en papa,

60
00:02:39,620 --> 00:02:40,380
‘Si,

61
00:02:40,380 --> 00:02:48,320
all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu,

62
00:02:48,320 --> 00:02:54,200
but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.

63
00:02:54,200 --> 00:02:59,800
But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo,

64
00:02:59,800 --> 00:03:03,080
yu kon kill di melu wey fat pass for am!’

65
00:03:03,080 --> 00:03:04,720
“Den di papa tell am,

66
00:03:04,720 --> 00:03:06,000
‘My pikin,

67
00:03:06,000 --> 00:03:11,320
yu always dey here with mi and evritin wey I get na yor own.

68
00:03:11,320 --> 00:03:13,840
But e good make I do party,

69
00:03:13,840 --> 00:03:15,800
bikos yor broda die before,

70
00:03:15,800 --> 00:03:16,840
but naw,

71
00:03:16,840 --> 00:03:18,520
e don kom back to life,

72
00:03:18,520 --> 00:03:20,200
e lost before,

73
00:03:20,200 --> 00:03:21,000
but naw,

74
00:03:21,000 --> 00:03:24,000
wi don si am.’ ”

