﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:08,560
Jesus enter Jeriko kon waka go inside di town.

2
00:00:08,560 --> 00:00:09,760
For der,

3
00:00:09,760 --> 00:00:11,760
e get one man wey en name bi Zakius.

4
00:00:11,760 --> 00:00:12,440
E get money well-well,

5
00:00:12,440 --> 00:00:15,480
bikos e bi tax kollectors oga.

6
00:00:15,480 --> 00:00:16,640
E don tey wey e

7
00:00:16,640 --> 00:00:17,840
dey won si Jesus,

8
00:00:17,840 --> 00:00:19,040
but e nor fit si am,

9
00:00:19,040 --> 00:00:21,280
bikos e bi short man and pipol too plenty.

10
00:00:21,280 --> 00:00:25,080
So e run go klimb one sikamore tree make e for fit si am,

11
00:00:25,080 --> 00:00:26,720
bikos Jesus go pass dat road.

12
00:00:26,720 --> 00:00:28,160
Wen Jesus rish dat place,

13
00:00:28,160 --> 00:00:29,920
e look up kon sey,

14
00:00:29,920 --> 00:00:30,880
“Zakius,

15
00:00:30,880 --> 00:00:32,840
kom down kwik-kwik,

16
00:00:32,840 --> 00:00:35,480
bikos I must stay for yor house today.”

17
00:00:35,480 --> 00:00:38,420
So Zakius kom down kon welkom Jesus with happiness.

18
00:00:38,420 --> 00:00:40,240
Wen di pipol si wetin happen,

19
00:00:40,240 --> 00:00:41,980
dem kon dey komplain dey sey,

20
00:00:41,980 --> 00:00:45,160
“Jesus don go visit dat man wey bi sina.”

21
00:00:45,160 --> 00:00:48,240
But Zakius stop kon tell Jesus,

22
00:00:48,240 --> 00:00:49,600
“Oga God si,

23
00:00:49,600 --> 00:00:54,860
I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before,

24
00:00:54,860 --> 00:00:57,000
I go pay am back four times!”

25
00:00:57,000 --> 00:00:59,200
Den Jesus sey,

26
00:00:59,200 --> 00:01:02,220
“Salvashon don kom dis house today,

27
00:01:02,220 --> 00:01:04,980
bikos dis man na Abraham pikin too.

28
00:01:04,980 --> 00:01:09,660
Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”

