﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,340
Afta Jesus tok dis word,

2
00:00:07,340 --> 00:00:08,560
e kon go Jerusalem.

3
00:00:08,560 --> 00:00:10,720
Wen e rish Betpage and Betany,

4
00:00:10,720 --> 00:00:13,040
for di place wey dem dey koll Mount Olives,

5
00:00:13,040 --> 00:00:15,260
e kon send two of en disciples sey,

6
00:00:15,260 --> 00:00:18,300
“Make una go di village wey dey front.

7
00:00:18,300 --> 00:00:19,840
Wen una enter,

8
00:00:19,840 --> 00:00:24,440
una go si one small donkey wey nobody don sidan put before,

9
00:00:24,440 --> 00:00:25,920
wey dem tie for der.

10
00:00:25,920 --> 00:00:27,840
Make una luz am kom give mi.

11
00:00:27,840 --> 00:00:29,920
If anybody ask una,

12
00:00:29,920 --> 00:00:31,520
‘Why una dey luz am?’

13
00:00:31,520 --> 00:00:32,720
Make una ansa,

14
00:00:32,720 --> 00:00:33,980
‘Di oga nid am.’ ”

15
00:00:33,980 --> 00:00:35,900
So di pipol wey dem send go,

16
00:00:35,900 --> 00:00:37,800
kon rish di place wey Jesus tell dem.

17
00:00:37,800 --> 00:00:39,340
As dem dey luz di donkey,

18
00:00:39,340 --> 00:00:41,020
di owner kon ask dem,

19
00:00:41,020 --> 00:00:42,740
“Why una dey luz am?”

20
00:00:42,740 --> 00:00:44,420
Dem ansa,

21
00:00:44,420 --> 00:00:46,480
“Di oga nid am.”

22
00:00:46,480 --> 00:00:49,380
Dem take di donkey kon put dia klot on-top am,

23
00:00:49,380 --> 00:00:51,080
den Jesus sidan put.

24
00:00:51,080 --> 00:00:52,820
As Jesus dey ride dey go,

25
00:00:52,820 --> 00:00:54,720
pipol kon spread dia klot for road.

26
00:00:54,720 --> 00:00:57,380
As e dey enter di road wey go Mount Olives,

27
00:00:57,380 --> 00:00:59,140
all di disciples kon dey happy,

28
00:00:59,140 --> 00:01:02,680
dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.

29
00:01:02,680 --> 00:01:07,020
“God don bless di king wey dey kom with en name!

30
00:01:07,020 --> 00:01:12,520
Make peace dey for heaven and make all di glory bi God own!”

31
00:01:12,520 --> 00:01:16,100
But some Farisee pipol wey dey among di pipol kon tell Jesus,

32
00:01:16,100 --> 00:01:18,260
“Tisha,

33
00:01:18,260 --> 00:01:20,220
make yu tell yor disciples make dem kwayet.”

34
00:01:20,220 --> 00:01:22,380
Jesus ansa,

35
00:01:22,380 --> 00:01:24,160
“I tell una true word,

36
00:01:24,160 --> 00:01:25,860
if dem kwayet,

37
00:01:25,860 --> 00:01:29,020
even stones go start to dey shaut!”

38
00:01:29,020 --> 00:01:30,800
Wen Jesus near Jerusalem,

39
00:01:30,800 --> 00:01:32,680
e look di town kon dey kry,

40
00:01:32,680 --> 00:01:34,940
den e sey,

41
00:01:34,940 --> 00:01:39,120
“I wish sey una know wetin go give una peace today!

42
00:01:39,120 --> 00:01:40,540
But naw,

43
00:01:40,540 --> 00:01:42,240
God don hide am from una.

44
00:01:42,240 --> 00:01:49,040
Time go kom wen una enemies go surround una for evry korna kon block una road.

45
00:01:49,040 --> 00:01:55,160
Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda,

46
00:01:55,160 --> 00:01:58,080
bikos di time wen God kom visit una,

47
00:01:58,080 --> 00:02:00,320
una nor know.”

