﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:07,520
Wen evening rish dat day,

2
00:00:07,520 --> 00:00:09,860
Jesus kon tell en disciples,

3
00:00:09,860 --> 00:00:13,240
“Make wi cross go di oda side for di river.”

4
00:00:13,240 --> 00:00:15,560
So afta dem leave di pipol,

5
00:00:15,560 --> 00:00:20,580
dem enter di boat wey Jesus sidan and oda boat still dey der with dem.

6
00:00:20,580 --> 00:00:21,520
Den,

7
00:00:21,520 --> 00:00:25,360
strong breeze kon dey blow and wota dey enter di boat,

8
00:00:25,360 --> 00:00:27,800
so di boat kon dey won sink.

9
00:00:27,800 --> 00:00:31,840
But Jesus put en head for pillow dey sleep inside di boat.

10
00:00:31,840 --> 00:00:32,200
Den,

11
00:00:32,200 --> 00:00:34,120
dem koll am dey sey,

12
00:00:34,120 --> 00:00:35,080
“Tisha,

13
00:00:35,080 --> 00:00:38,280
yu nor even kare sey wi won die?”

14
00:00:38,280 --> 00:00:41,280
So Jesus get up kon kommand di breeze,

15
00:00:41,280 --> 00:00:43,600
den e tell di river,

16
00:00:43,600 --> 00:00:45,640
“Make yu kwayet!”

17
00:00:45,640 --> 00:00:50,040
Di breeze stop and evriwhere kon kwayet at wons.

18
00:00:50,040 --> 00:00:51,560
Den Jesus tell dem,

19
00:00:51,560 --> 00:00:53,800
“Why una dey fear?

20
00:00:53,800 --> 00:00:56,140
Una still nor get faith?”

21
00:00:56,140 --> 00:01:00,220
Fear katch dem well-well and dem kon dey ask each oda,

22
00:01:00,220 --> 00:01:02,380
“Who dis man bi sef?

23
00:01:02,380 --> 00:01:06,800
Even breeze and river dey obey am!”

