﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:10,360
Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep,

2
00:00:10,360 --> 00:00:12,600
Jesus disciples kon ask am,

3
00:00:12,600 --> 00:00:16,580
“Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”

4
00:00:16,580 --> 00:00:20,860
Jesus send two disciples go for front kon tell dem,

5
00:00:20,860 --> 00:00:22,960
“Wen una enter di town,

6
00:00:22,960 --> 00:00:26,020
una go si one man wey karry wota kontaina.

7
00:00:26,020 --> 00:00:27,400
Make una follow am.

8
00:00:27,400 --> 00:00:29,140
Di house wey e go enter,

9
00:00:29,140 --> 00:00:31,780
make una tell di pesin wey get am sey,

10
00:00:31,780 --> 00:00:34,300
‘Di Tisha sey make wi ask,

11
00:00:34,300 --> 00:00:38,860
“Where di room wey mi and my disciples go for chop Passova food?” ’

12
00:00:38,860 --> 00:00:43,680
E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey.

13
00:00:43,680 --> 00:00:46,420
Make una prepare evritin for der.”

14
00:00:46,420 --> 00:00:51,860
So en disciples go di town and dem si evritin just as Jesus tell dem sey e go bi,

15
00:00:51,860 --> 00:00:55,360
dem kon prepare di Passova food for der.

16
00:00:55,360 --> 00:00:57,500
Wen evening rish,

17
00:00:57,500 --> 00:01:00,000
Jesus kon go di house with en twelf disciples.

18
00:01:00,000 --> 00:01:02,040
As dem dey chop for di tabol,

19
00:01:02,040 --> 00:01:03,580
Jesus kon sey,

20
00:01:03,580 --> 00:01:05,420
“I tell una true word,

21
00:01:05,420 --> 00:01:08,080
one of una wey dey chop with mi,

22
00:01:08,080 --> 00:01:10,540
go sell mi give my enemies.”

23
00:01:10,540 --> 00:01:13,680
Wetin Jesus tok kon dey worry di disciples for mind,

24
00:01:13,680 --> 00:01:16,120
so dem kon dey ask am one-by-one,

25
00:01:16,120 --> 00:01:17,500
“Oga God!

26
00:01:17,500 --> 00:01:18,660
Na mi?”

27
00:01:18,660 --> 00:01:20,380
Jesus ansa,

28
00:01:20,380 --> 00:01:24,040
“Na one of una wey dey follow mi chop for di same plate.

29
00:01:24,040 --> 00:01:28,220
Man Pikin go die as dem rite for God word about am,

30
00:01:28,220 --> 00:01:31,100
but curse dey di pesin head wey go sell am.

31
00:01:31,100 --> 00:01:35,240
E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”

32
00:01:35,240 --> 00:01:36,900
As dem dey chop,

33
00:01:36,900 --> 00:01:38,200
Jesus take bread,

34
00:01:38,200 --> 00:01:39,460
tank God,

35
00:01:39,460 --> 00:01:42,460
den divide am give en disciples kon sey,

36
00:01:42,460 --> 00:01:44,860
“Make una take and chop,

37
00:01:44,860 --> 00:01:46,780
bikos dis na my body.”

38
00:01:46,780 --> 00:01:48,020
Afta,

39
00:01:48,020 --> 00:01:49,020
e take cup,

40
00:01:49,020 --> 00:01:50,260
tank God,

41
00:01:50,260 --> 00:01:52,460
den e give en disciples and all of dem,

42
00:01:52,460 --> 00:01:53,560
drink from inside.

43
00:01:53,560 --> 00:01:55,620
E kon tell dem,

44
00:01:55,620 --> 00:01:58,260
“Dis na my blood,

45
00:01:58,260 --> 00:02:00,700
di kovenant blood wey I pour for evribody.

46
00:02:00,700 --> 00:02:02,540
I tell una true word,

47
00:02:02,540 --> 00:02:04,340
I nor go drink wine again,

48
00:02:04,340 --> 00:02:08,480
until di day wen I go drink di new wine for God Kingdom.”

49
00:02:08,480 --> 00:02:10,560
Afta dem don sing one hymn,

50
00:02:10,560 --> 00:02:12,860
dem kon enter inside Mount Olives.

