﻿1
00:00:05,000 --> 00:00:06,580
Afta six days,

2
00:00:06,580 --> 00:00:08,120
Jesus take Pita,

3
00:00:08,120 --> 00:00:10,540
James and John (wey bi James broda),

4
00:00:10,540 --> 00:00:12,860
go on-top one high mountin.

5
00:00:12,860 --> 00:00:15,660
Jesus body kon shange.

6
00:00:15,660 --> 00:00:20,080
En face kon dey shine like sun and en dress kon white.

7
00:00:20,080 --> 00:00:24,100
At wons Moses and Elijah kon appear dey tok to Jesus.

8
00:00:24,100 --> 00:00:26,140
So Pita kon tell Jesus,

9
00:00:26,140 --> 00:00:27,420
“Oga God,

10
00:00:27,420 --> 00:00:29,200
e good make wi stay here.

11
00:00:29,200 --> 00:00:30,180
If yu like,

12
00:00:30,180 --> 00:00:32,520
I go build three tent:

13
00:00:32,520 --> 00:00:33,820
one for yu,

14
00:00:33,820 --> 00:00:37,320
one for Moses and one for Elijah.”

15
00:00:37,320 --> 00:00:38,980
As e still dey tok,

16
00:00:38,980 --> 00:00:42,900
one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey,

17
00:00:42,900 --> 00:00:45,980
“Dis na my Pikin wey I love.

18
00:00:45,980 --> 00:00:48,640
Make una listin to am!”

19
00:00:48,640 --> 00:00:50,620
Wen di disciples hear di vois,

20
00:00:50,620 --> 00:00:53,640
dem fear kon fall face groun.

21
00:00:53,640 --> 00:00:55,760
But Jesus tosh dem kon sey,

22
00:00:55,760 --> 00:00:56,960
“Stand up!

23
00:00:56,960 --> 00:00:58,440
Make una nor fear.”

24
00:00:58,440 --> 00:01:00,060
Wen dem look up,

25
00:01:00,060 --> 00:01:01,740
di only pesin wey dem si,

26
00:01:01,740 --> 00:01:02,820
na Jesus.

27
00:01:02,820 --> 00:01:05,300
As dem dey kom down from di mountin,

28
00:01:05,300 --> 00:01:07,300
Jesus warn dem sey,

29
00:01:07,300 --> 00:01:14,780
“Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”

30
00:01:14,780 --> 00:01:17,140
Di disciples ask am,

31
00:01:17,140 --> 00:01:22,280
“Why di law tishas dey tish sey na Elijah go first kom?”

32
00:01:22,280 --> 00:01:24,220
Jesus ansa,

33
00:01:24,220 --> 00:01:29,940
“Na true sey Elijah go first kom and e go ripair evritin.

34
00:01:29,940 --> 00:01:31,220
And I tell una sey,

35
00:01:31,220 --> 00:01:33,580
dat Elijah don kom,

36
00:01:33,580 --> 00:01:35,420
but pipol nor know am,

37
00:01:35,420 --> 00:01:38,620
instead dem do am as dem like.

38
00:01:38,620 --> 00:01:39,740
Na so too,

39
00:01:39,740 --> 00:01:42,740
God Pikin go sofa for dia hand.”

40
00:01:42,740 --> 00:01:47,460
Den di disciples kon know sey e dey tell dem about John di Baptist.

